Chineke merem ebere!

News Express |26th May 2020 | 3,870
Chineke merem ebere!

I speak in tongues today becos e get as e be. And I tank our union member Emeka becos na for im mouth I dey always hear Chineke merem ebere!

If Emeka wan eat, e go say Chineke merem ebere. If you do Emeka someting wey pain am, e go say Chineke merem ebere. If Emeka win Baba Ijebu, e go say Chineke merem ebere.

If Emeka make mistake mess, e go say Chineke merem ebere. And if e see any Lagos sisi wey don package both front and back waka pass our garage wey dey near Ikeja under bridge, Emeka go shout Chineke merem ebere!

I don dey ask Emeka tipe tipe make e tell me wetin dis talk mean, e no gree.

But na one day I set trap for Emeka. I carry am go Madam Shine Buka wey dey near Airport Hotel. I tell Emeka make e drink and chop anyting e like. Emeka come use oju kokoro drink and chop pepper soup yanfu yanfu.

First, e order for Shine Shine Bobo. Wen e finish two bottle, as e see me drink My Usual, e order for di same ting. Emeka first chop chicken pepper soup, as e finish two plate and see me chop orisirisi pepper soup, e shout Chineke merem ebere! I say make dem give am orisirisi too.

Na wen drink don enter Emeka eye, na im I take style ask am wetin be di meaning of Chineke merem ebere. Na dat time Emeka quick quick tell me say e mean “God have mercy on me” I come talk am for my mind say, so na dis ting dis bobo dey talk every time?

Last Sunday wey be Sallah afraid catch me, no be small.

I say make I put my guonguoro for like four hour, den go back go relax for house with my family. But wen I enter road, e come be like say all di passenger dey wait for me make I jus come out.

E come be di time wey our Muslim broda and sister dem dey go for prayer ground as dem finish fasting. If you see as dem rush me, ehn!

De first family wey stop me reach like 20 people. Dem say make I try carry all of dem at di same time. I tell dem say na only three I fit carry for dis Coro time – one for front, two for back.

Dem say dem go lap, I say no. Dem say ok, make I drop dem set by set. I gree. As di first set of 3 wan enter, I give dem my soap water make dem take wash dia hand, after dat I say make dem wear dia facemask. Na only one of dem get am, I come bring out facemask give dose wey no get.

Na so I go drop dem for prayer ground for Moshalashi Alhaja.

I run go back go carry di second set di same way I carry di first. I go again go carry di next set.

Na wen I carry di last set go, I no come see road again, everywia don full plus including di prayer ground gan gan.

Dem reach like 10,000 people wey jam togeder like sand for Bar Beach, and plenty no use facemask. For dis Coro time?

I no know wen I shout, Chineke merem ebere!

I use style drop dem, collect my money, revise my guonguoro and go back for my house.

Make we jam again on Friday.

Tank you.

Tank you very much.

And tank you very, very much indeed.

Comments

Post Comment

American missionary disgraces Reno Omokri

American missionary disgraces Reno Omokri

Why soldiers are yet to get their allowances — Defence Headquarters

Why soldiers are yet to get their allowances — Defence Headquarters

Confusion in court as woman slumps after husband insists on divorce

Confusion in court as woman slumps after husband insists on divorce

MRA blows hot as INEC demands N1.5bn to produce Voters Register and list of polling units in Nigeria

MRA blows hot as INEC demands N1.5bn to produce Voters Register and list of polling units in Nigeria

Police, NBA set up committee to review tinted permit regulations

Police, NBA set up committee to review tinted permit regulations

Electoral Act Amendment: Akpabio decries alleged injustice in 2019 elections

Electoral Act Amendment: Akpabio decries alleged injustice in 2019 elections

Herbert Macaulay’s descendants reject group pardon, tell Tinubu to honour him separately

Herbert Macaulay’s descendants reject group pardon, tell Tinubu to honour him separately

We have uncovered plot to destabilise our party — Imo ADC

We have uncovered plot to destabilise our party — Imo ADC

JOA 2025: Fear of the unknown

JOA 2025: Fear of the unknown

Ondo: Army vows expedited discipline of soldier involved in commercial driver’s death

Ondo: Army vows expedited discipline of soldier involved in commercial driver’s death

Mama Rainbow celebrates 83rd birthday, 60 years on stage

Mama Rainbow celebrates 83rd birthday, 60 years on stage

US Senator Ted Cruz urges congress to pass Nigeria religious freedom accountability act

US Senator Ted Cruz urges congress to pass Nigeria religious freedom accountability act

Just in: Rivers cancels N134 bn contract awarded by Ibas, orders refund

Just in: Rivers cancels N134 bn contract awarded by Ibas, orders refund

Senate steps down electoral bill for more consultations

Senate steps down electoral bill for more consultations

I never represented Tinubu at 2023 presidential election petitions court — Amupitan

I never represented Tinubu at 2023 presidential election petitions court — Amupitan

Defections in Bayelsa are motivated by stomach infrastructure — Civil liberties organisation chairman

Defections in Bayelsa are motivated by stomach infrastructure — Civil liberties organisation chairman

Chamber of Commerce, NDDC release N1.5B to boost businesses in Niger Delta

Chamber of Commerce, NDDC release N1.5B to boost businesses in Niger Delta

As billionaire wealth soars $33 trillion, Mark Cuban says it’s time for workers to receive a cut of their employers’ success in the form of stocks

As billionaire wealth soars $33 trillion, Mark Cuban says it’s time for workers to receive a cut of their employers’ success in the form of stocks

NCAA, Orji Kalu in war of words over pilots’ competence, drug allegations

NCAA, Orji Kalu in war of words over pilots’ competence, drug allegations

Motorists jubilate as Customs sells intercepted petrol at N600/litre in Ibadan

Motorists jubilate as Customs sells intercepted petrol at N600/litre in Ibadan

Thursday, October 16, 2025 5:00 PM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025