NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.
As I drop dat my passenger wey be oga patapata of Cabby Finance Company for Yaba,begin dey fire my guonguoro dey go back with di loan Form, I no even branch our garage wey dey near Ikeja under bridge. I go straight to Abule Egba wey me and my family dey live.
My people surprise to see me by dat time. Me wey dey come back house for night every day. Na my two woman pikin dem – Bisi and Funke – first rush come greet me as I wan pack my guonguoro.
I ask dem wia dia mama dey, dem say e dey cook night food wey we go chop. Na im Funke come ask me wetin make I come back early today. I tell am say better don land. Quick, quick I bring out di loan Form wey dat my passenger give me and show dem.
I no know wen I begin sing di song wey I dey always hear for my wife Bose mouth: “He has done for me. He has done for me. He has done for me. He has done for me. What my father cannot do. He has done for me…”
Na so Bose lef wetin e dey cook for backyard, run come join us for parlour. Na so Bose, Bisi and Funke join me as we dey sing di song and dance togeder.
Small time, Bose say wait o, dis one wey im jus come follow dey sing and dance, we no even tell am wetin shele.
Na im I hand over di loan Form give am. Bose look di Form ti-ti-ti-ti, den come ask, “Na wetin dis one come mean nah.”
I say make everybody siddon. As dem siddon, I come begin tell dem di hole tori – How I carry one passenger for drop go Yaba. How di man like di way I take drive am for my guonguoro. How I tell am my long experience as Lagos taxi driver. How di man tell me say na my type im company dey find to give loan to take support dia business. How e give me di loan Form make I fiil and return to am. How di loan go come within one week make I take am buy tear rubber car. How di man give me im business card and I come see say na oga patapata of Cabby Finance Company di man be...
I tell my family say my lucky don arrive!
Na so Bose begin sing dat song again, and all of us join am dey dance as we sing di song: “He has done for me…”
(To be continued)
Make we jam again on Friday.
Tank you.
Tank you very much.
And tank you very, very much indeed.