ADVERTISEMENT
ADVERTISEMENT

I don begin carry bie bie like Osama

News Express |17th Jan 2020 | 1,429
I don begin carry bie bie like Osama

Anybody wey dey do dis our taxi driver work for Lagosand e no get sense, na im be saydi person go peme sharp, sharp.

Di kind orisirisi ting wey don happen since dis new year show face don reach to make me tink twice, even thrice sef.

Una kukuma remember dat day wey one bobo like dat carry me for drop go VGC for night and abandon me dia, sote e nearly use man head do isiewu, if no be say Eledumare dey with me dat night.

Una also remember di order day wen anoder passenger say make I helep am hide white powder for my petrol tank, and we no know say olopa dey monitor us since we comot for our garage wey dey near Ikeja under bridge. Tori Olorun!

Since dat day, I don decide say I no go jus siddon like dat, I must to do someting.

I don see say all dis bad people don see me finish. Wen dem enter my guonguoro, dem go only see di four akola mark wey scatter for my face. Na so my face smooth like bottle, no single bie bie. Na im make dem dey tink say I be gentle man, so dey can treat me anyhow.

Now, I wan make dem sabi say na me be di original agbero. MC Olomo na my boy.

Dat’s why, since dis week, I don begin grow bie bie. I no dey shave again. Na white bie bie from my head to toe. I wan make di bie bie even grow pass Osama own. I go allow my own grow reach my knee so dat any passenger wey I carry no go talk to me or behave anyhow. E go maintain. I wan make dem see me as Area Fada.

But come o, I hope people no go run patapata wen dem se me with Osama bie bie and I no go come see any passenger carry again o.

Any way sha, I still dey tink am.

Make we jam again on Tuesday.

Tank you.

Tank you very much.

And tank you very, very much again.

Comments

Post Comment

Monday, June 23, 2025 12:32 PM
ADVERTISEMENT
Over 70 years Shell banner
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025