NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.
Since dis month of odun enter, I dey listen to news every time.
Na im make I make sure say petrol dey for house 24/7 – even if na two liter – to take power my “I better pass my nebor” gen, as leprosy don catch NEPA tipe tipe.
Since dis month, wen I wake up for morning, I must listen to radio or watch TV for tiwa ntiwa news before I begin go our garage wey dey near Ikeja under bridge.
Yesterday sef, as I carry one passenger like dat go drop for Idumota for Isale Eko, I buy car radio and fix for my guonguoro. At list make I no miss any news wen I dey for road.
Me and news now don become 5 and 6. I no take news play ra-ra-ra.
But since wen I don dey listen to news, di main di main ting wey I wan hear for inside di news, I never hear am yet. And keresimasi don reach finish.
I dey listen to news weda dem go talk say dem don open border. But noting like dat till today.
Up till now wey I dey nack una dis tori so, dem still dey lock border. No turkey, no chicken, no rice, no ororo to take do Xmas. Tori Olorun!
Na dis matter I siddon dey tink ti-ti-ti for garage yesterday. Our union member Akpan ask me wetin I dey tink. Na wen I tell am dis border closure matter, na im I come know say na di same ting everybody dey tink.
But Akpan come talk say, as di border matter come dey like dis, im and im family don decide to use wetin dey available to take enjoy dis Xmas.
Akpan say dem don decide to kill and roast 404 for dis odun. And only one 404 go dey enough for Xmas and New Year.
And if you hear di kind ogbonge benefits wey Akpan talk say 404 meat dey carry join body, my broda you no go wait for person to beg you to go for 404 meat.
Why me and my family go dey drink bitter agbo and squeeze our face every day wen 404 meat go drive malaria and typhoid one time and also serve us big time for dis keresimasi? Double action!
Akpan, e go better for you for your good idea. But di big question be say, will my wife Bose and our two woman pikin dem – Bisi and Funke – buy dis wonderful idea?
Make we jam again on Tuesday.
Tank you.
Tank you very much.
And tank you very, very much indeed.