Na only Eledumare go save man pikin for dis taxi driver work.
Na im make Bose, my wife dey always talk am say na ashawo work I dey do.
And I dey always tell am say, if ashawo work (according by you) dey put food for our table, na im be say ashawo work na better work nah. Abi how una see am?
Yesterday I carry one passenger for drop go Mushin for morning. Come see di kind Go-slow wey dey for dat Agege Motor Road. From our garage wey dey near Ikeja under bridge, reach Shogunle bus stop take us like one hour.
Na for inside dat heavy traffic Bose call me for phone. E say I no come drop di food money wey I suppose to drop for house before I begin go garage.
I no know wen I shout, Olorun Oba o! My passenger sef shock, e ask me wetin happen.
I tell my passenger say make e no fear, say noting serious happen. Di bobo say noting serious and I come shout like dat?
Na im I beg am make e no vex, say na family matter. Di bobo say as I shout like dat, e tink say weda my guonguoro wan catch fire, say e nearly jump comot.
Wetin make me shout be say, I remember Bose tell me say e wan go market, dat noting remain for house wey di family go chop.
Quick, quick I call Bose back. I tell am make e take okada for dat our area, Abule Egba, begin dey go wait for me for our garage, make I rush go drop passenger for Mushin.
As me and my passenger dey go, my mind no dey dia again. All di ting wey e talk, I jus dey answer am one kind. Everyting, I go say “na wa o”, “na so?”, “shioo?”. My mind no dey dia at all. I sure say dat my passenger go don talk am for im mind say which kind man be dis?
Sha, I manage go drop di bobo for Mushin. And Go-slow no dey for return. Come see di kind speed wey I use take rush back to garage like say na dose wintch VIO dem dey pursue me.
As I jus land for garage, Bose don already arrive, dey wait for me. I see am siddon with one sisi like dat.
I park my guonguoro and come down to quickly give Bose food money. Wen I look well well, I see say na Bose and Sikiratu siddon togeder, dey discuss. Tori Olorun!
(To be continued)
Make we jam again on Friday.
Tank you.
Tank you very much.
And tank you very, very much indeed.
NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.