Every day, na im new name dey come out for dis our obodo Naija.
Tele tele na Nnamdi Kanu. After dat na Evans, follow by El-Zakzaky, den Coza. Di next one naslapping Sinator, and now na Sowore.
Since last week, na Sowore dey for everybody mouth. And di name dey cause wahala, no be small.
Na so two bobo take me for drop on Monday, dem say make I carry dem goSurulere.
As we dey go , na im di two both of demdey talkabout revelation matter. Me, I just dey do like say I no hear dem.But all my ear dey for wetin dem dey talk.
Di first bobo talk say im like di revolution wey Sowore dey do (Na only God know wetin be revolution). E say dis our contry don dabaru patapata, say im support Sowore well, well. E say na revolution be am, dat’s why im dey go join Sowore for Surulere.
Di second bobo ask am weda na becos of Sowore di first bobo tell am make e follow am go Surulere.
“Segun, you say make I follow you reach Surulere, why you no tell me say na Sowore matter you dey go for?”
“Uche, I sabi say if I tell you say na revolution march I dey go, you no go gree follow me.”
Segun ask Uche why e dey do like say all di ting wey dey happen for dis Naija no concern am. E say if e no concern am now, e go concern im pikin, grand and great great grand pikin dem.
Uche ask weda Segun dey curse am, Segun tell am say no be curse but na true talk.
Uche tell Segun say wetin concern am concern Sowore and im revolution march, say weda no be di same man wey collect plenty money for di same people hand dat time to finish Naija Oga patapatateletele make dis present oga take over. E say wetin make Sowore come dey fight im ATM now?
As Uche just talk dat one, na im Segun call Uche olori bruku, Uche call Segun anu ohia. Na sodem just dey curse demsef ti-ti-ti-ti, till we climb Jibowu bridge, cross Ojuelegba and enter Barrack bus stop den begin face Stadium.
Di next ting I hear na ppuuaarrhh! Den double ppuuaarrhh, ppuuaarrhh!!! Fight don shele be dat … for inside my guonguoro. Tori Olorun!
Segun hold Uche for neck, Uche hold Segun for brokos. Na im I match break and clear for roadside, one time. See as dis two bobo wan kill demsef for inside my guonguoro for wetin I no know o.
Tank God say di olopa wey dey stand for under dat stadium bridge dey dia. I take style signal di olopa make e come.
Segun and Uche just dey fight, dem no even see wen di olopa don land with gun. Dat time everywia don full, una kukuma sabi Lagos people dem. Dem just tanda dey count point like refree for di two fighter bobo, instead make dem separate dem.
Na im olopa just release one bullet for air pooorrrhhhh!!! Everybody scatter. Me sef collect my money for Segun hand before I begin find my way and lef dem for olopa hand.
I come talk am for my mind say, see wetin Sowore cause o.
Make we jam again on Tuesday.
Tank you.
Tank you very much.
And tank you very, very much indeed.
NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.