NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.
I come talk am for my mind say na which kind wahala be dis? How dis madam go just use im extra large boysquarter dey burst my tyre per second, per second?Which kind wintch passenger be dis?My broda, I tire.
I come look weda Sule and im Road Safety Oga still dey around make dem for helep me use dia van tow my guonguoro comot for on top of di IBB Bridge. But dem no dey dia again. Tori Olorun!
I look di madam, I no know wetin I go tell am. Di ting be say, if I look di madam face, e go look my face too, and e go come smile one kind wicked smile wey go just melt my heart patapata, and all di vex wey dey my heart go vamus.
I see di madam bring out im phone for handbag begin make call. But my mind no even dey dia. Wetin dey my mind na howI go take carry my guonguoro comot for on top IBB Bridge, and how I go take discharge dis madam with full load for im backyard, di load wey put me for dis tyre wahala.
I no tink finish wey one car like dat park near my guonguoro. I see madam go meet di driver. After, di madam come back come tell me say im don call Uber to come carry am.
Di madam give me double di money wey e suppose to pay. E come still give me money make I take buy two tyre wey im kini destroy. But e tell me say make I make sure say na original tyre I buy, even di spare tyre.
I come tank di madam well well. As e enter di Uber siddon, I see say di Uber tanda paparapa, e no shake body like my guonguoro.
Di madam bring out im business card give me. E look me, I look am. Den e come give me dat im wintch smile wey dey melt my heart. E wave me, I wave am back. Na so di Uber driver begin dey go. I tanda for dia dey wave di madam till dem disappear.
I go back go fix my back tyre wey burst dat time. Now I dey find original spare tyre make I buy keep, who know, I fit carry dat madam again, any time, any day. After all, im business card dey my hand.
Make we jamagain on Tuesday.
Tank you.
Tank you very much.
And tank you very, very much indeed.