NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.
Yesterday na real roffu roffu day for me. Since I begin do dis my taxi driver work for Lagos, I never see day wey be like yesterday. I swear!
E be like say dem ring bell say make all di woman dem wey carry extra-large boysquarter (backyard) take me for drop, from morning till night. And my guonguoro hear nwi.
One madam first stop me near my street for Abule Egba as I just comot for house dat early morning to go our garage wey dey for near Ikeja under bridge.
As I stop for di madam, I look am, e look me. I take style look im boysquarter, afraid catch me.
Di madam sabi wetin dey my mind, e say make I no worry, say e understand and e go pay extra.
Na im I come smile, after all no be money man dey look for?
Di madam say make I carry am for drop go Balogun market for Isale Eko. I tell am my price, di madam gree... plus di extra.
I open passenger front door for am, di madam say e wan siddon for back seat, say front no go fit carry di two both of us.
E use im hand open di back door. As e just enter siddon, my guonguoro faint. Di hole motor just land for ground like say e no get even one tyre again.
Tank God say vulca way dey work for dat street come out early. I tell di vulca make e drag im pumping machine cross come wia my guonguoro dey.
Di vulca gauge di four tyre 60. E say anyting less dan dat, di car no go fit move. Di vulca say make I dey go small, small becos if di tyre struggle too much, all di four tyre dem go burst at di same time.
Na so I come dey go, I no speed pass 50 Kmph. We pass 7-Up, enter Alapere, den reach Oworonshoki.
Tank God say go-slow dey small dat morning for road, if no be so, I for cause traffic for dat kind waka wey my guonguoro waka like snail for expressway.
But una kukuma sabi say car cannot waka like dat for on top IBB Bridge, you cannot drive less dan 100 Kmph.
As I just say make I match trottle small reach like 80 Kmph, na so I hear ppppuuuaaahhh!!! My two back tyre don scatter be dat. For on top IBB Bridge? Olorun Oba o!
I clear for road and park for corner of di bridge. I come down and open door for di madam make e come down. As di madam come down, come see as my guonguoro breathe up ffiiiaaaamm!
Di madam look me, I look am. E come smile one kind wicked smile like dat. I come talk am for my mind say no be your fault, na money wey I dey find, na im make me carry Dunlop Elite like you.
I use my spare tyre change one, but e still come remain one tyre to change. Di next ting I see na towing van for di back of my guonguoro. Tori Olorun!
(To be continued)
Make we jam again on Tuesday.
Tank you.
Tank you very much.
And tank you very, very much indeed.