ADVERTISEMENT
ADVERTISEMENT

Sikiratu tell me say, If you Coza me I Busola you (2)

News Express |5th Jul 2019 | 3,023
Sikiratu tell me say, If you Coza me I Busola you (2)

Up till now wey I dey nack una dis tory so, Sikiratu no tell me wetin dis kind talk mean.

I move near am again, to see weda e really serious say make my hand no touch am, Sikiratu shout again say, “Oga MAT I don tell you o. Respect your old age o. Make your hand no touch me o. Sebi I don tell you before say if you Coza me I Busola you. No talk say I no warn you o!”

I no just come understand Sikiratu again. Tori Olorun.

See dis buka girl wey no dey let me rest o. Every day Sikiratu go say Oga MAT take me out make we go enjoy oursef. For Xmas, for Sallah, na di same ting, e no dey ever let me rest. So na today dis yeye girl sabi say I be old man? After e don chop all my money finish? See me, see wahala.

As Sikiratu warn me finish, e just waka dey go back to im place of work – Madam Shine Buka wey dey near Airport Hotel.

One mind say make I go meet am for dia, anoder mind say make I call am for phone, make e no go embaras me for dia beer parlour.

As I siddon dey tink wetin I go do to Sikiratu, na im Idowu, our union Treasurer drive enter garage.

I come tell Idowu every ting wey happen and wetin Sikiratu talk – “If you coza me...”

As I just mention coza, na im Idowu shout, Oti o!

Idowu come beg me say if na so Sikiratu talk, make I no just go near am lai lai again.

I come talk am for my mind say Idowu wan block me so dat im go take style enter Sikiratu.

I ask Idowu why e tell me make I run for my Siki Babe. Na im Idowu say, if I like mysef, my family and dis my taxi driver work, make I just take wetin im tell me.

E say if no be so, dis my guoguoro I no go drive am again becos Sikiratu go force me step aside and pack my guonguoro.

Me, pack my guonguoro? Olorunmaje!

Since wey I run comot for my village Ogbomoso come Lagos, di only work I don do after I finish my mecho apprentice, na dis my taxi driver work. Anyting wey go make me lef di work, na im be say dat ting no like me at all, at all.

I beg Idowu tire make e tell me wetin di ting wey Sikiratu talk mean, Idowu just dey tell me “Beware! Oga MAT beware! Beware!!!”

So Idowu sef no gree tell me wetin dis coza talk mean, but no how, no how, I must find out. I swear!

Make we meet again on Tuesday.

Tank you.

Tank you very much.

And tank you very, very much indeed.

Comments

Post Comment

Sunday, June 22, 2025 5:19 PM
ADVERTISEMENT
Over 70 years Shell banner
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025