NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.
Wen man don dey take salt drink garri since e born, di day wey e make mistake use sugar drink di garri, dat day e go tink say im be god.
Di hole of yesterday I dey road – from one passenger to anoder.
I carry one passenger go drop for V.I, as I begin dey come back, anoder passenger take me for drop again go Yaba.
As di passenger dey open door to come down, anoder one say make I carry am go Ajah.
For Ajah again, one passenger like dat carry me go Epe. Dat one even dey beg me sef becos e sabi say Epe no be for here.
Truout dat yesterday, na so I just dey drive from Mainland to Island, Island to Mainland, and so on and so forth.
I come tire. But I like am so. What of dose day wey we no dey see one passenger sef carry, from morning to night?
As I come back from Epe, before I reach our garage wey dey for near Ikeja under bridge, 7 O’clock pm in di evening don nack.
I for pass go my house for Abule Egba, but I say make I just show face for garage before I begin go house.
Na only our union chairman Jimoh I meet for garage. As Jimoh just see me, e jump up, e no even allow me pack my guonguoro well.
E come open driver door for me sef make I come down. I say shoooo, which dey dis kind respect start?
Jimoh say e happy well well as I still come reach garage dat evening, e say e get someting wey e wan discus with me.
I ask am wetin be dat. Jimoh come tell me say, as our union dey grow, everyting sef don follow dey grow. E say sebi before before we be only 7 taxi driver for dat garage. But now we pass 20.
I tell Jimoh say make e go straight to di point and stop all dis introduction to physics.
Jimoh say as im be branch chairman for dis our union wey don dey grow, say im dey consider to get person wey go dey follow am for back, dey carry im bag and file if we go for meeting.
And if we go for dat kind big meeting for Alausa wey we go meet Oga Sanwo-Olu, di person go first come down, den turn come open im own door for am make e come down - as im open my own driver door wen I drive enter garage dat time.
Na im I ask Jimoh weda na “boy boy” or na bodyguard im dey find. Jimoh say no, say na P.A im want. E say weda I get person wey I go fit bring come give am.
I tell am say I go put eye, make e give me like one week, say I go get back to am.
Jimoh say one week too far. E say weda I don forgot say our next meeting for Alausa na dis week Friday.
Di next ting be say, Jimoh say im sabi say I be di Union secretary, but since I no go school wey make Akpan dey helep me take minutes for meeting, weda I for like to change office and become im P.A.
Olorun Oba o! I ask Jimoh say, me, your P.A?
If una see di kind eye wey I take look Jimoh dat evening, ehn, nobody tell am to run comot for wia I dey.
See Jimoh o. So dis branch chairman wey im be don dey make am craze?
Jimoh don forgot say all of us dey do park work, and anybody wey dey work for park na agbero – weda na motor park, tipper park, molue park, keke Marwa park, okada park, even BRT and Lagbus park – park na park and na agbero all of us be. Period. Oloriburu!
Make we jam again on Friday.
Tank you.
Tank you very much.
And tank you very, very much indeed.