ADVERTISEMENT

Helep! I don carry ogbologbo passenger dem

News Express |21st Jun 2019 | 2,662
Helep! I don carry ogbologbo passenger dem

I dey always talk am say, di orisirisi tings wey we taxi driver dey take our mouth see for Lagos road, our eye no fit talk am finish.

Every day, na new ting man pikin dey see. Some na good, some na bad. Some fit take man to di next level (no be like dia own o), and some fit put man head for ground sef. Olorunmaje!

Na so I go drop one passenger yesterday for Festac. As I drive come out for dat Lagos/Badagryexpressway make I climb dat Mile Two overhead bridge come begin face Oshodi, na im two bobo like dat stop me.

Dem carry one hand bag follow body. Dem say make I carry dem for drop go Ogudu GRA for dat Alapere side.

I tell dem my price, dem gree. I say make dem enter. Di two both of dem enter for back seat. Na im I begin fire dey go.

We no even go one meter sef wen dem open di bag wey dem carry. Dem comot someting wey dem tie for white paper. Di ting sef na white like powder wey woman dem dey take rob for face.

Dem no know say I dey take style dey look dem for my inside mirror.

I see say dem put di powder for dia nose, like say dem dey take native snuff.

Wen dem sniff am, dem go close dia eye, dem come go shake dia head like say spirit catch dem. By di time dem open dia eye, e go red like fire.

Dem do dis ting like three times, me I just dey look dem. I come dey wonder wetin dis two bobo dem dey do for inside my guonguoro. I come tink say weda na di new snuff wey oyibo bring out be dat.

Di next ting be say, di one wey carry bie bie wey long like Osama own come ask me, “Sorry sir, please can we make use of your car lighter?”

I tell am: “Sorry, Sir, dis my taxi no get dat kind ting.”

Di second bobo come say: “Shit men! Why did we board this old school cab owned by this old school pap?”

I just do like say I no hear dat one. Sebi my own na to drop dem make I collect my money.

Di Osama come remember say dem carry matches for inside dia bag. Na im e bring out di matches. E also bring two wrap of igbo come out, e give one to im second and try to light im own.

I talk am for my mind say dis bobo dem no sabi who Oga MAT be. Smoke igbo for inside my guonguoro? Who born dog!

Na so I clear for road side, stop, open my door and come out. I open dia door too.

I ask dem why dem wan do wetin dem wan do so.

Osama say: “So what? What the fuck are you talking about? Is it a crime to light ganja? O, what a shit!”

I ask am say if e don shit finish, make dem come down.

Di second bobo wey slim pass di needle wey tailor dem dey use come dey hala: “Fuck you old school pap! Is it because we decided to board this old school cab that’s why you wanna insult us? Look, it’s Uber we rock, not this scrap. Fuck you men!”

I tell dem say if dem don finish, make dem come down. I open di door wide.

Osama come down, he wan touch me, na im I tell am say if e try am, im hand go stand still, e no go come down again lai lai.

I no know say as all dis ting dey go on, one soja wey dey guard dat petrol station wey dey near dey hear us.

Di soja come ask me who dem be. I tell am say na for road dem stop me say make I drop dem for Ogudu GRA, say I no sabi dem before.

Di soja come point gun for dia head, say make dem lie down flat for dat main road. Come see as Osama and im second dey crawl for ground, dey beg soja.

Di soja come tell me make I dey go. As I enter my guonguoro wan go, olopa dem full dia van wan pass. Na im di soja stop di olopa van, hand over Osama and im needle size partner-in-crime to dem.

Me, I don dey go my way. I see for side mirror as olopa dey trowey dem for inside dia van.

Nonsense and ingredient!

Make we jam again on Tuesday.

Comments

Post Comment

France limits lifetime benefits for former prime ministers

France limits lifetime benefits for former prime ministers

Wild jubilation in Rivers over reinstatement of Fubara by Tinubu

Wild jubilation in Rivers over reinstatement of Fubara by Tinubu

From surpassing Jack Ma to losing $6B: How Popmart billionaire Wang Ning’s fortune skyrockets and then plunges with the Labubu hype

From surpassing Jack Ma to losing $6B: How Popmart billionaire Wang Ning’s fortune skyrockets and then plunges with the Labubu hype

Court restrains NUPENG, truck drivers from disrupting Dangote Refinery

Court restrains NUPENG, truck drivers from disrupting Dangote Refinery

Power couple Jay-Z, Beyoncé have $57M mortgage — are they ‘broke billionaires’ or is something else going on? Moneywise Sun, Sep 14, 2025, 9:11 AM 7 min read  In this articl

Power couple Jay-Z, Beyoncé have $57M mortgage — are they ‘broke billionaires’ or is something else going on? Moneywise Sun, Sep 14, 2025, 9:11 AM 7 min read In this articl

Billionaire businessman who eclipsed Elon Musk as world's richest man held 'advanced talks' over takeover of Premier League club

Billionaire businessman who eclipsed Elon Musk as world's richest man held 'advanced talks' over takeover of Premier League club

ABC to indefinitely halt Jimmy Kimmel Live! after Charlie Kirk remarks

ABC to indefinitely halt Jimmy Kimmel Live! after Charlie Kirk remarks

Cardi B reveals she is expecting a child with NFL player Stefon Diggs

Cardi B reveals she is expecting a child with NFL player Stefon Diggs

Taliban orders ban on internet in northern Afghanistan ‘to prevent immoral activities’

Taliban orders ban on internet in northern Afghanistan ‘to prevent immoral activities’

England striker Harry Kane exploited error-prone Chelsea to score twice in Bayern Munich's 3-1 Champions League win.

England striker Harry Kane exploited error-prone Chelsea to score twice in Bayern Munich's 3-1 Champions League win.

Holders Paris St-Germain made the perfect start to the defence of their Champions League title with an emphatic win against Atalanta.

Holders Paris St-Germain made the perfect start to the defence of their Champions League title with an emphatic win against Atalanta.

Atletico Madrid manager Diego Simeone regrets clashing with Liverpool supporters at the end of their dramatic Champions League opener at Anfield - but says they were sparked by "insults".

Atletico Madrid manager Diego Simeone regrets clashing with Liverpool supporters at the end of their dramatic Champions League opener at Anfield - but says they were sparked by "insults".

King and Trump hail UK-US special relationship in state banquet speech

King and Trump hail UK-US special relationship in state banquet speech

W’Cup Qualifiers: South Africa absent from FIFA sanction list

W’Cup Qualifiers: South Africa absent from FIFA sanction list

Texas billionaire who loves subprime auto loans next to buy NBA team

Texas billionaire who loves subprime auto loans next to buy NBA team

Benue varsity clears promotion backlog, 146 Lecturers get Associate, full Professorship

Benue varsity clears promotion backlog, 146 Lecturers get Associate, full Professorship

Cristiano Ronaldo will play on with Portugal for 'as long as he wants' with Roberto Martinez confident 40-year-old striker can lead the team at 2026 World Cup

Cristiano Ronaldo will play on with Portugal for 'as long as he wants' with Roberto Martinez confident 40-year-old striker can lead the team at 2026 World Cup

Lagos market massacre: Death toll rises after police shooting

Lagos market massacre: Death toll rises after police shooting

OFFICIAL: 420 communities attacked in Plateau, almost 12,000 killed in 24 years — Fact-Finding Committee

OFFICIAL: 420 communities attacked in Plateau, almost 12,000 killed in 24 years — Fact-Finding Committee

Heavy mourning as FIRS loses 4 senior staff in Lagos fire (SEE NAMES)

Heavy mourning as FIRS loses 4 senior staff in Lagos fire (SEE NAMES)

Thursday, September 18, 2025 9:01 AM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025