ADVERTISEMENT

All dis Lagos sisi dem no go kill di son of man o!

News Express |18th Jun 2019 | 3,315
All dis Lagos sisi dem no go kill di son of man o!

If I tell una all di orisirisi tings dem wey man pikin dey see for Lagos road in di curse (Olorun maje) of my duty, una no go believe. Una go tink say I dey form am.

But weda or wedan’t una believe, all dose tings dey happen. If I talk lie, make I baf naked for bafroom. Helep me say Amin!

Na so di order day, one sisi like dat waka enter our garage wey dey for near Ikeja under bridge.

If you see dis sisi, hmm, you go begin wonder weda na mama born am. And if you no take time, na so you go wonder sote you go become wanderer.

Di sisi come dey form fone for me. Di place wey e go call like African babe, e go wan set im tongue like oyibo. And na so I come dey say ehn? ehn? ehn? like say I be deaf.

Before I understand say e wan make I carry am go for Mafoluku, I don ask am "ehn?" reach like one million time. If you hear as di sisi call Mafoluku, you go tink say e no dey shit sef.

If you see wetin dis sisi wear, Tori Olorun!

Di dress just cover im nyansh small, and na so e take am tie im nyansh sote I come dey pity di nyansh like say na me e tie.

Di shoe wey di sisi wear na di type wey Yaba bend down boutique boys dey call 9 inches to heaven.

Im face nko? I no come know di sisi and Ekpo Calabar who fine pass. I sure say di sisi spend time well well for mirror to paint im face to dat level. I pity di face gan.

Anywia sha, wetin e wear no concern me. My own na to carry passenger make e pay me. Dat’s all.

I tell di sisi my price, e gree. I open back door for am, e tell me say im wan siddon for front. I say no troublem, dat e fit siddon anywia e like.

I turn go open my driver door and enter, di sisi never still enter.

E open di door to enter. E carry one leg up, but to enter, na wahala. Di dress too short and e too tight

Na im e carry leg again, to try weda e go fit enter, for wia! Go no go!

I just take style dey look am. Small time I ask am say se kosi o, e say abeg make I comot come first.

I come talk am for my mind say today na today.

As I comot go meet am for passenger front door, e tell me say make I helep carry am for leg, den use my second hand push im nyansh small so dat im body go fit enter inside my guonguoro. Olorun Oba o!

Which kind temptation be dis? Why art thou temptest di son of man?

But wetin I go do? No be me wan do taxi driver work for Lagos?

I use style carry im one leg, e enter, I come carry di second leg while I push im nyansh make e follow di leg enter. As e land for di seat, anybody wey dey dat place go don see everyting wey di sisi wear for yonder. Di G-string no just hide.

Na so we begin dey go Mafoluku. Di sisi come ask me weda I don vex for am, I say why I go vex? I tell am say as customer concern, my work na to render service - anyhow, anyhow.

But I come use style ask am weda e dey live with im mama and papa for Lagos. E say na im aunty e dey live with, say im mama and papa dey for village.

I ask am weda dat im aunty no see am di time e dey comot for house. Di sisi come look me, e say why I ask am dat kind question? E say wetin concern im aunty, concern wetin im wear? E say di aunty dey do im own, im sef dey do im own.

As e dey talk so, one of im leg dey face Sokoto, di order one Calabar.

Di sisi come tell me say, as I see am so, na mid-week service e dey go for church and e don late, make I drive quick small.

Na dat time my body come weak patapata. Church ke? My mouth just gum, I no fit talk again. I just manage press trottle dey go make I drop am.

And as we reach di place for Mafoluku, true true na one big church like dat. People don full trowey. As I march break, to carry am comot for my guonguoro make e enter di church come take anoder one hour.

I manage drop am sha, and e pay me my money. I come turn begin dey go my way.

Na only Olorun go helep di pastor and all di bobo dem for dat church. And any wife for dat church wey no hold im husband well, na im sabi.

Make we jam again on Friday.

Tank you.

Tank you very much.

And tank you very, very much indeed.

Comments

Post Comment

Court restrains NUPENG, truck drivers from disrupting Dangote Refinery

Court restrains NUPENG, truck drivers from disrupting Dangote Refinery

Power couple Jay-Z, Beyoncé have $57M mortgage — are they ‘broke billionaires’ or is something else going on? Moneywise Sun, Sep 14, 2025, 9:11 AM 7 min read  In this articl

Power couple Jay-Z, Beyoncé have $57M mortgage — are they ‘broke billionaires’ or is something else going on? Moneywise Sun, Sep 14, 2025, 9:11 AM 7 min read In this articl

Billionaire businessman who eclipsed Elon Musk as world's richest man held 'advanced talks' over takeover of Premier League club

Billionaire businessman who eclipsed Elon Musk as world's richest man held 'advanced talks' over takeover of Premier League club

ABC to indefinitely halt Jimmy Kimmel Live! after Charlie Kirk remarks

ABC to indefinitely halt Jimmy Kimmel Live! after Charlie Kirk remarks

Cardi B reveals she is expecting a child with NFL player Stefon Diggs

Cardi B reveals she is expecting a child with NFL player Stefon Diggs

Taliban orders ban on internet in northern Afghanistan ‘to prevent immoral activities’

Taliban orders ban on internet in northern Afghanistan ‘to prevent immoral activities’

England striker Harry Kane exploited error-prone Chelsea to score twice in Bayern Munich's 3-1 Champions League win.

England striker Harry Kane exploited error-prone Chelsea to score twice in Bayern Munich's 3-1 Champions League win.

Holders Paris St-Germain made the perfect start to the defence of their Champions League title with an emphatic win against Atalanta.

Holders Paris St-Germain made the perfect start to the defence of their Champions League title with an emphatic win against Atalanta.

Atletico Madrid manager Diego Simeone regrets clashing with Liverpool supporters at the end of their dramatic Champions League opener at Anfield - but says they were sparked by "insults".

Atletico Madrid manager Diego Simeone regrets clashing with Liverpool supporters at the end of their dramatic Champions League opener at Anfield - but says they were sparked by "insults".

King and Trump hail UK-US special relationship in state banquet speech

King and Trump hail UK-US special relationship in state banquet speech

W’Cup Qualifiers: South Africa absent from FIFA sanction list

W’Cup Qualifiers: South Africa absent from FIFA sanction list

Texas billionaire who loves subprime auto loans next to buy NBA team

Texas billionaire who loves subprime auto loans next to buy NBA team

Benue varsity clears promotion backlog, 146 Lecturers get Associate, full Professorship

Benue varsity clears promotion backlog, 146 Lecturers get Associate, full Professorship

Cristiano Ronaldo will play on with Portugal for 'as long as he wants' with Roberto Martinez confident 40-year-old striker can lead the team at 2026 World Cup

Cristiano Ronaldo will play on with Portugal for 'as long as he wants' with Roberto Martinez confident 40-year-old striker can lead the team at 2026 World Cup

Lagos market massacre: Death toll rises after police shooting

Lagos market massacre: Death toll rises after police shooting

OFFICIAL: 420 communities attacked in Plateau, almost 12,000 killed in 24 years — Fact-Finding Committee

OFFICIAL: 420 communities attacked in Plateau, almost 12,000 killed in 24 years — Fact-Finding Committee

Heavy mourning as FIRS loses 4 senior staff in Lagos fire (SEE NAMES)

Heavy mourning as FIRS loses 4 senior staff in Lagos fire (SEE NAMES)

Marketers demand N1.5trn subsidy to match refinery gantry price — Dangote

Marketers demand N1.5trn subsidy to match refinery gantry price — Dangote

Pension arrears: Obi slams FG, demands immediate payment to senior citizens

Pension arrears: Obi slams FG, demands immediate payment to senior citizens

2027: APC not scared of Jonathan — National Chairman

2027: APC not scared of Jonathan — National Chairman

Thursday, September 18, 2025 8:54 AM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025