ADVERTISEMENT

Dem say I must marry second wife (2)

News Express |11th Jun 2019 | 3,178
Dem say I must marry second wife (2)

Na so di four both of my village elder dem waka come wia I siddon. I kukuma come do like say I no see dem tele tele.

I come form happiness. I open my teeth, do like say e too sweet me to see dem for my garage. Dem sef happy well well to see me.

Di first elder ask me weda I no remember am again. I say no, but dat im face resemble somebody wey I sabi.

Di elder say me and im be classmate tipe tipe for our village night school. Say, weda I don forgot dat boy wey dey siddon after di table wey me and Arike dey siddon for Standard 5. I come shout im name, Segun! Na so we come emBreast oursef.

Na dat time di order 3 elder dem come introduce demsef, one by one. I come see say I even senior dem. I come talk am for my mind say na only God know wetin make dem old like say na dem senior Pa Awo.

Dem come ask me wetin I dey chop wey make me still look like bobo. I tell dem say na God. Dem say dis Lagos favour me no be small. I say na God.

I ask dem wetin make I give dem, dem say dem no go take anyting, say na di Kabiyesi of our village for Ogbomosho send dem come meet me.

Dem say if I wan give dem anyting, no be for garage, dat I must take dem go my house wia dem go deliver di message wey Kabiyesi send dem.

Me? Kabiyesi? Message? My house? My village people?

I say well, we go go my house, but first I must use water take welcome dem as our tradition talk am. Water na for peace nah.

Na im I call di mama wey dey sell pure water for our garage. I say make e bring four bottle water come, cold one.

As I give my village elder dem di water, dem say so na dis kind water I dey drink, no wonder my body fresh like young bobo own. All of us come laugh togeder.

My phone begin ring. I pick di call. Na Bose my wife. Bose ask me for phone say wia I dey. I tell am say I dey with some people for garage.

Bose ask me which people be dat. I lie to my wife say dem be passenger wey wan take me for charter. Bose say e see danger, make I just dey careful and make I try close quick dat day and come house early. I tell Bose say okay, no troublem.

Bose say but no matter wetin di enemy don plan, God go return am back to sender. E say im dey pray since wen God show am di vision dat morning.

Dat ting wey my wife talk touch me well well. Any time Bose talk like dat, I no dey take am play becos Bose na real prayer warrior for dia church, and e dey see road well well.

My village elder dem say dem don ready make we dey go my house make dem go deliver Kabiyesi message, say dem must go back to village dat same day.

Wetin Bose talk for phone just enter my mind. Se na dis my village elder dem be di danger wey Bose see for vision? If na dem, wetin make I do? Abi I go tell dem say I no go carry dem go my house?

Well, na one time man dey take peme. I tell dem make dem come enter my guonguoro make we begin go my house. I open door for dem, and all of dem enter.

(To be continued)

Make we jam again on Friday.

Tank you.

Tank you very much.

And tank you very, very much indeed.

Comments

Post Comment

France limits lifetime benefits for former prime ministers

France limits lifetime benefits for former prime ministers

Wild jubilation in Rivers over reinstatement of Fubara by Tinubu

Wild jubilation in Rivers over reinstatement of Fubara by Tinubu

From surpassing Jack Ma to losing $6B: How Popmart billionaire Wang Ning’s fortune skyrockets and then plunges with the Labubu hype

From surpassing Jack Ma to losing $6B: How Popmart billionaire Wang Ning’s fortune skyrockets and then plunges with the Labubu hype

Court restrains NUPENG, truck drivers from disrupting Dangote Refinery

Court restrains NUPENG, truck drivers from disrupting Dangote Refinery

Power couple Jay-Z, Beyoncé have $57M mortgage — are they ‘broke billionaires’ or is something else going on? Moneywise Sun, Sep 14, 2025, 9:11 AM 7 min read  In this articl

Power couple Jay-Z, Beyoncé have $57M mortgage — are they ‘broke billionaires’ or is something else going on? Moneywise Sun, Sep 14, 2025, 9:11 AM 7 min read In this articl

Billionaire businessman who eclipsed Elon Musk as world's richest man held 'advanced talks' over takeover of Premier League club

Billionaire businessman who eclipsed Elon Musk as world's richest man held 'advanced talks' over takeover of Premier League club

ABC to indefinitely halt Jimmy Kimmel Live! after Charlie Kirk remarks

ABC to indefinitely halt Jimmy Kimmel Live! after Charlie Kirk remarks

Cardi B reveals she is expecting a child with NFL player Stefon Diggs

Cardi B reveals she is expecting a child with NFL player Stefon Diggs

Taliban orders ban on internet in northern Afghanistan ‘to prevent immoral activities’

Taliban orders ban on internet in northern Afghanistan ‘to prevent immoral activities’

England striker Harry Kane exploited error-prone Chelsea to score twice in Bayern Munich's 3-1 Champions League win.

England striker Harry Kane exploited error-prone Chelsea to score twice in Bayern Munich's 3-1 Champions League win.

Holders Paris St-Germain made the perfect start to the defence of their Champions League title with an emphatic win against Atalanta.

Holders Paris St-Germain made the perfect start to the defence of their Champions League title with an emphatic win against Atalanta.

Atletico Madrid manager Diego Simeone regrets clashing with Liverpool supporters at the end of their dramatic Champions League opener at Anfield - but says they were sparked by "insults".

Atletico Madrid manager Diego Simeone regrets clashing with Liverpool supporters at the end of their dramatic Champions League opener at Anfield - but says they were sparked by "insults".

King and Trump hail UK-US special relationship in state banquet speech

King and Trump hail UK-US special relationship in state banquet speech

W’Cup Qualifiers: South Africa absent from FIFA sanction list

W’Cup Qualifiers: South Africa absent from FIFA sanction list

Texas billionaire who loves subprime auto loans next to buy NBA team

Texas billionaire who loves subprime auto loans next to buy NBA team

Benue varsity clears promotion backlog, 146 Lecturers get Associate, full Professorship

Benue varsity clears promotion backlog, 146 Lecturers get Associate, full Professorship

Cristiano Ronaldo will play on with Portugal for 'as long as he wants' with Roberto Martinez confident 40-year-old striker can lead the team at 2026 World Cup

Cristiano Ronaldo will play on with Portugal for 'as long as he wants' with Roberto Martinez confident 40-year-old striker can lead the team at 2026 World Cup

Lagos market massacre: Death toll rises after police shooting

Lagos market massacre: Death toll rises after police shooting

OFFICIAL: 420 communities attacked in Plateau, almost 12,000 killed in 24 years — Fact-Finding Committee

OFFICIAL: 420 communities attacked in Plateau, almost 12,000 killed in 24 years — Fact-Finding Committee

Heavy mourning as FIRS loses 4 senior staff in Lagos fire (SEE NAMES)

Heavy mourning as FIRS loses 4 senior staff in Lagos fire (SEE NAMES)

Thursday, September 18, 2025 9:01 AM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025