NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.
Una welcome from odun o.
Di Ileya sweet, no be small. Our union chairman Jimoh and our treasurer Idowu, invite di rest of our union member dem to dia house make we come follow dem open mouth after di long fasting. No be small open mouth o!
Since dat Tuesday wey be Ileya, na yesterday Thursday di two both of dem – Jimoh and Idowu – resume work for garage. And dem still bring Ileya fowl meat and drink come share.
Dem kukuma sabi say my usual na “odekun” a.k.a “who send you come?” a.k.a "Black September” a.k.a “black oil”. Idowu own na “monkey tail”, Akpan own na “palmy” a.k.a “white wash”. Emeka own nko? Dat one na “akpeteshi” a.k.a “killervin”. And Jimoh own na Alomo or “Baby Oku”.
Jimoh and Idowu bring all di above come garage yesterday make we take complete di Ileya.
Di ting come be like small party for our garage wey dey for near Ikeja under bridge.
All dose Ipodo area boy dem complete for our garage dat yesterday. Dia own sef, dem bring Igbo join am - all jumbo size like Abami Eda own. Ileya continue!
Na for inside dat enjoyment four elder like dat waka enter our garage. As I see wetin dem wear, I just know one time say na my village people come so.
Dem first go meet Akpan say dem wan see Oluwafemi. Akpan tell dem say nobody like dat dey for our garage. Me I just dey one corner take style dey look dem.
Akpan ask dem wetin di Oluwafemi dey do. Dem say dem hear for village say na taxi driver e dey do. Akpan ask dem weda di person no get anoder name. Dem say di person full name na Oluwafemi Olugbemiro Olusalako.
Akpan say make dem go check for anoder taxi park, say nobody like dat dey for here.
As dem wan waka comot, Akpan say make dem describe di person wey dem dey find. Dem say e don tey well well wey di person lef village come Lagos. Say di village dey for Ogbomosho and di person get four big tribal mark for face.
As Akpan just hear Ogbomosho and four tribal mark for face, e say make dem wait, im dey come.
Akpan begin waka come my direction, and so my four village elder dem take sight me.
As dem just see me, all of dem shout at di same time, “Na im be dat!”
(To be continued)
Make we jam again on Tuesday.
Tank you.
Tank you very much.
And tank you very, very much indeed.