ADVERTISEMENT

Me sef wan take oath of office

News Express |31st May 2019 | 2,679
Me sef wan take oath of office

Power sweet, no be small. See as that Wednesday dem say make our Union people and orders come show face for Democracy Day.

Me, I tire well well, becos di day before dat Wednesday, I carry one passenger like dat, plus including im wife and two pikin, go Epe. And na for midnight I take reach my house wey dey for Abule Egba.

So, na for house I siddon watch everyting wey dey happen for TV – as Buhari and Osinbajo, dey swear on top one big book like dat.

NEPA no kuku dey as usual, so na di small fuel wey remain for inside my guonguoro tank I take mouth and pipe draw put for generator.

As I dey watch di TV, I say make I change channel, na im I see say di same ting wey our oga patapata and im second dey swear, na so governor dem and dia second dey swear put.

Wetin come sweet me pass be say, di big book wey dem dey swear put, na person helep dem hold am. Di microphone wey dem dey talk inside, na anoder person dey hold am.

And as dem swear finish, wan go siddon for dia seat, anoder person don tanda gidigba to make sure say dem siddon well.

Di ting come sweet me, no be small. Di ting wey come make me like our oga patapata dat Wednesday be say, as e swear finish, e just waka comot, lef everybody for dia.

All di people wey come dia to hear di plenty grammar wey go trowey for oga patapata mouth no even sabi wen oga enter motor comot and lef dem for dia. Tori Olorun!

Na as I dey see all di ting wey happen for TV, I come remember say since wen me, Jimoh, Idowu , Emeka and Akpan become our Union executive, dem never give us swear make we swear for on top of oath of office.

Na im make I tell Jimoh (our Union branch chairman) say im number one mandate now na to organise event wey all of us go use our own book and swear oath for our own office too.

And wen I swear finish, I go just enter motor comot for dia, I no go talk anyting. Se na talk we go chop?

Make we jam again on Tuesday.

Tank you.

Tank you very much.

And tank you very, very much indeed.



Comments

Post Comment

Court restrains NUPENG, truck drivers from disrupting Dangote Refinery

Court restrains NUPENG, truck drivers from disrupting Dangote Refinery

Power couple Jay-Z, Beyoncé have $57M mortgage — are they ‘broke billionaires’ or is something else going on? Moneywise Sun, Sep 14, 2025, 9:11 AM 7 min read  In this articl

Power couple Jay-Z, Beyoncé have $57M mortgage — are they ‘broke billionaires’ or is something else going on? Moneywise Sun, Sep 14, 2025, 9:11 AM 7 min read In this articl

Billionaire businessman who eclipsed Elon Musk as world's richest man held 'advanced talks' over takeover of Premier League club

Billionaire businessman who eclipsed Elon Musk as world's richest man held 'advanced talks' over takeover of Premier League club

ABC to indefinitely halt Jimmy Kimmel Live! after Charlie Kirk remarks

ABC to indefinitely halt Jimmy Kimmel Live! after Charlie Kirk remarks

Cardi B reveals she is expecting a child with NFL player Stefon Diggs

Cardi B reveals she is expecting a child with NFL player Stefon Diggs

Taliban orders ban on internet in northern Afghanistan ‘to prevent immoral activities’

Taliban orders ban on internet in northern Afghanistan ‘to prevent immoral activities’

England striker Harry Kane exploited error-prone Chelsea to score twice in Bayern Munich's 3-1 Champions League win.

England striker Harry Kane exploited error-prone Chelsea to score twice in Bayern Munich's 3-1 Champions League win.

Holders Paris St-Germain made the perfect start to the defence of their Champions League title with an emphatic win against Atalanta.

Holders Paris St-Germain made the perfect start to the defence of their Champions League title with an emphatic win against Atalanta.

Atletico Madrid manager Diego Simeone regrets clashing with Liverpool supporters at the end of their dramatic Champions League opener at Anfield - but says they were sparked by "insults".

Atletico Madrid manager Diego Simeone regrets clashing with Liverpool supporters at the end of their dramatic Champions League opener at Anfield - but says they were sparked by "insults".

King and Trump hail UK-US special relationship in state banquet speech

King and Trump hail UK-US special relationship in state banquet speech

W’Cup Qualifiers: South Africa absent from FIFA sanction list

W’Cup Qualifiers: South Africa absent from FIFA sanction list

Texas billionaire who loves subprime auto loans next to buy NBA team

Texas billionaire who loves subprime auto loans next to buy NBA team

Benue varsity clears promotion backlog, 146 Lecturers get Associate, full Professorship

Benue varsity clears promotion backlog, 146 Lecturers get Associate, full Professorship

Cristiano Ronaldo will play on with Portugal for 'as long as he wants' with Roberto Martinez confident 40-year-old striker can lead the team at 2026 World Cup

Cristiano Ronaldo will play on with Portugal for 'as long as he wants' with Roberto Martinez confident 40-year-old striker can lead the team at 2026 World Cup

Lagos market massacre: Death toll rises after police shooting

Lagos market massacre: Death toll rises after police shooting

OFFICIAL: 420 communities attacked in Plateau, almost 12,000 killed in 24 years — Fact-Finding Committee

OFFICIAL: 420 communities attacked in Plateau, almost 12,000 killed in 24 years — Fact-Finding Committee

Heavy mourning as FIRS loses 4 senior staff in Lagos fire (SEE NAMES)

Heavy mourning as FIRS loses 4 senior staff in Lagos fire (SEE NAMES)

Marketers demand N1.5trn subsidy to match refinery gantry price — Dangote

Marketers demand N1.5trn subsidy to match refinery gantry price — Dangote

Pension arrears: Obi slams FG, demands immediate payment to senior citizens

Pension arrears: Obi slams FG, demands immediate payment to senior citizens

2027: APC not scared of Jonathan — National Chairman

2027: APC not scared of Jonathan — National Chairman

Thursday, September 18, 2025 8:55 AM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025