ADVERTISEMENT

I don hammer! (2)

News Express |28th May 2019 | 2,812
I don hammer! (2)

I ask di oyibo woman wia I dey carry am go, e say make we dey go Sheraton Hotel. I tell am say I sabi di place well well. E say im sef sabi wia Sheraton dey, even as e no go dia before for im life. E say na di first time e come Naija be dis since wen e born for America 30 year ago.

I ask am how e take sabi wia Sheraton dey if e no come Naija since dem born am. Di oyibo say im dey look di Sheraton sef as we dey go so for road.

Afraid come catch me. I come talk am for my mind say I don carry oyibo wintch today for my guonguoro. I take style use corner eye look am, I see say di oyibo woman dey look im phone ti-ti-ti.

Im phone no be like dis my Nokia torch light o. Na big man phone e carry, and na only God know as e take dey see di place we dey go for inside di phone.

Small time, di oyibo tell me say im name na Jane. E say im papa and mama na big people for America, in short, e say Trump na im papa. I ask am who? E say Trump, di presido.

See as my body come dey shake like Shakespeare. I come dey look am ti-ti-ti like say I drink one drum of lookozade, sote I nearly drive enter bush. Me, carry Trump pikin for inside my guonguoro? Olorun Oba o!

By dis time we don reach Sheraton gate. I drive enter di compound. As I just march break fiam, some uniform worker dem for Sheraton rush come carry di load wey dey for inside my guonguoro.

My mind na to collect my money, begin rush go tell my Union people for our garage say I don carry Trump pikin today for dis my guonguoro.

But Jane come tell me say make I follow am go im hotel room for up.

I first tink say weda I no hear am well. I ask am wetin e talk, e say make I follow am go im room make we go dey discuss. E say na becos of me e come Naija, say im don dey read all Oga MAT sweet sweet tori dem for America, dat’s why e tell im papa say im wan come meet dis Oga MAT face to face for Naija. And im papa arrange everyting for am here for Naija before e begin come.

My broda, I weak. So me and Trump pikin wan go siddon togeder for inside di same room for Sheraton dey discuss?

I come talk am for my mind say I don hammer today. I no know wen I begin dey sing praises . . .

Na so I come dey hear person tap me for my shoulder pom, pom,pom. Idowu say: “Oga MAT, dis one wey you come siddon here for garage dey sing praises, abi you don hammer for inside dream? Better go meet Iyalagbo now o.” Torin Olorun!

Make we jam again on Friday.

Tank you.

Tank you very much.

And tank you very, very much indeed.



Comments

Post Comment

Court restrains NUPENG, truck drivers from disrupting Dangote Refinery

Court restrains NUPENG, truck drivers from disrupting Dangote Refinery

Power couple Jay-Z, Beyoncé have $57M mortgage — are they ‘broke billionaires’ or is something else going on? Moneywise Sun, Sep 14, 2025, 9:11 AM 7 min read  In this articl

Power couple Jay-Z, Beyoncé have $57M mortgage — are they ‘broke billionaires’ or is something else going on? Moneywise Sun, Sep 14, 2025, 9:11 AM 7 min read In this articl

Billionaire businessman who eclipsed Elon Musk as world's richest man held 'advanced talks' over takeover of Premier League club

Billionaire businessman who eclipsed Elon Musk as world's richest man held 'advanced talks' over takeover of Premier League club

ABC to indefinitely halt Jimmy Kimmel Live! after Charlie Kirk remarks

ABC to indefinitely halt Jimmy Kimmel Live! after Charlie Kirk remarks

Cardi B reveals she is expecting a child with NFL player Stefon Diggs

Cardi B reveals she is expecting a child with NFL player Stefon Diggs

Taliban orders ban on internet in northern Afghanistan ‘to prevent immoral activities’

Taliban orders ban on internet in northern Afghanistan ‘to prevent immoral activities’

England striker Harry Kane exploited error-prone Chelsea to score twice in Bayern Munich's 3-1 Champions League win.

England striker Harry Kane exploited error-prone Chelsea to score twice in Bayern Munich's 3-1 Champions League win.

Holders Paris St-Germain made the perfect start to the defence of their Champions League title with an emphatic win against Atalanta.

Holders Paris St-Germain made the perfect start to the defence of their Champions League title with an emphatic win against Atalanta.

Atletico Madrid manager Diego Simeone regrets clashing with Liverpool supporters at the end of their dramatic Champions League opener at Anfield - but says they were sparked by "insults".

Atletico Madrid manager Diego Simeone regrets clashing with Liverpool supporters at the end of their dramatic Champions League opener at Anfield - but says they were sparked by "insults".

King and Trump hail UK-US special relationship in state banquet speech

King and Trump hail UK-US special relationship in state banquet speech

W’Cup Qualifiers: South Africa absent from FIFA sanction list

W’Cup Qualifiers: South Africa absent from FIFA sanction list

Texas billionaire who loves subprime auto loans next to buy NBA team

Texas billionaire who loves subprime auto loans next to buy NBA team

Benue varsity clears promotion backlog, 146 Lecturers get Associate, full Professorship

Benue varsity clears promotion backlog, 146 Lecturers get Associate, full Professorship

Cristiano Ronaldo will play on with Portugal for 'as long as he wants' with Roberto Martinez confident 40-year-old striker can lead the team at 2026 World Cup

Cristiano Ronaldo will play on with Portugal for 'as long as he wants' with Roberto Martinez confident 40-year-old striker can lead the team at 2026 World Cup

Lagos market massacre: Death toll rises after police shooting

Lagos market massacre: Death toll rises after police shooting

OFFICIAL: 420 communities attacked in Plateau, almost 12,000 killed in 24 years — Fact-Finding Committee

OFFICIAL: 420 communities attacked in Plateau, almost 12,000 killed in 24 years — Fact-Finding Committee

Heavy mourning as FIRS loses 4 senior staff in Lagos fire (SEE NAMES)

Heavy mourning as FIRS loses 4 senior staff in Lagos fire (SEE NAMES)

Marketers demand N1.5trn subsidy to match refinery gantry price — Dangote

Marketers demand N1.5trn subsidy to match refinery gantry price — Dangote

Pension arrears: Obi slams FG, demands immediate payment to senior citizens

Pension arrears: Obi slams FG, demands immediate payment to senior citizens

2027: APC not scared of Jonathan — National Chairman

2027: APC not scared of Jonathan — National Chairman

Thursday, September 18, 2025 8:54 AM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025