ADVERTISEMENT

I don hammer!

News Express |24th May 2019 | 3,092
I don hammer!

Any how wey pikin be, im mama must still like am becos nobody know wetin dat pikin go be tomorrow.

Who know weda dat pikin na im go be presido like Buhari or nimonia, sorry mi . . . mil . . . millio . . . (abeg make una helep me complete am) like Dangote.

Even for alagba age like me, person fit still jam luck, as me sef jam luck yesterday.

I reach our garage wey dey near Ikeja under bridge early dat yesterday morning. I siddon ti-ti-ti, passenger no show face. And I no see any of our union member dem.

Na later I hear for di small radio wey dey inside my guonguoro as Road Safety oga talk say Julius Berger dey repair Lagos/Ibadan Expressway. Na im cause di kind Go-slow wey be say even snail go run pass motor.

I come talk am for my mind say, which year dis people go ever repair dat road finish make people rest? Yesterday, repair. Today, repair. Tomorrow nko, repair. Haba! Na so so repair every day. Kilode?

Na di ting wey I siddon dey tink for garage wen small sleep just carry me . . .

Small time I hear grin, grin, grin! Na my torch light phone dey ring be dat. I look di number, I no sabi di person.

As I pick di call, na one sisi voice I hear. Di way di sisi take talk for phone, you go tink say e no dey shit. In short, di sisi wan talk oyibo pass oyibo people sef.

Na wen I gum my ear for my phone well well, na im I come dey understand small small wetin di sisi dey talk.

Di sisi talk say im be announcer for Lagos International Airport, say make I report for airport kia kia. E say wen I reach airport make I call dat number wey e use call me.

Me, report for airport? Na wetin I do? Who be di person wey wan see me? Abi na 419?

Well, man die but once. I know say I no do anybody bad, my hand clean. Na im I jump inside my guonguoro, open ignition, kick di engine, put am for gear one and move. Airport straight!

As I reach for dat airport toll gate, dem open di gate for me. Dem no ask me for money. I stop make I bring out money pay dem, di man ask me, “Oga MAT?” I say yes. E signal me make I dey go. I shock. And I no fit wait to ask am how e take sabi me and my guonguoro becos order motor wey wan pay for toll gate plenty for my back.

I reach airport car park, na di same ting, dem no wan collect parking money for my hand.

Na im I ask di car park man why e no wan collect money, di man ask me weda no be me be Oga MAT, I tell am say na me, e say somebody don pay for my parking.

I say who and how e take sabi my guonguoro? Di man say im no sabi di person but dem just pay and give am my guonguoro number. Tori Olorun!

I bring out my phone and call di sisi wey call me dat time. E ask me wia I dey, I tell am say I dey for airport car park. E say make I wait, somebody go meet me now.

E no reach 5 minute, I see two people carry load dey come for my guonguoro. As dem see me, dem stop. Dem say “Oga MAT, abeg open your boot make we put di load.” I ask dem who dem be, dem say di owner of di load dey follow dem for back.

As I come down make I open di boot, I see one oyibo woman wey im nose long like from Agege go reach Sango Ota.

Di oyibo woman rush and embreast me as e just see me. E say “Ahhh, it’s nice to meet you for di very first time, Oga MAT! I always enjoy reading your stories in faraway US.”

I just open my mouth dey look am as e dey talk pra-pra-pra like say e chop hot plantain.

E say make I open my guonguoro boot make dose people put im load. As dem put di load for boot finish, e bring out dollar for im shokoto back pocket and settle dem.

Di load people wan happy die. Dollar? Di oyibo say make I open di front passenger door for am, I open and e enter. E say make we dey go.

(To be continued)

Make we jam again on Tuesday.

Tank you.

Tank you very much.

And tank you very, very much indeed.



Comments

Post Comment

Court restrains NUPENG, truck drivers from disrupting Dangote Refinery

Court restrains NUPENG, truck drivers from disrupting Dangote Refinery

Power couple Jay-Z, Beyoncé have $57M mortgage — are they ‘broke billionaires’ or is something else going on? Moneywise Sun, Sep 14, 2025, 9:11 AM 7 min read  In this articl

Power couple Jay-Z, Beyoncé have $57M mortgage — are they ‘broke billionaires’ or is something else going on? Moneywise Sun, Sep 14, 2025, 9:11 AM 7 min read In this articl

Billionaire businessman who eclipsed Elon Musk as world's richest man held 'advanced talks' over takeover of Premier League club

Billionaire businessman who eclipsed Elon Musk as world's richest man held 'advanced talks' over takeover of Premier League club

ABC to indefinitely halt Jimmy Kimmel Live! after Charlie Kirk remarks

ABC to indefinitely halt Jimmy Kimmel Live! after Charlie Kirk remarks

Cardi B reveals she is expecting a child with NFL player Stefon Diggs

Cardi B reveals she is expecting a child with NFL player Stefon Diggs

Taliban orders ban on internet in northern Afghanistan ‘to prevent immoral activities’

Taliban orders ban on internet in northern Afghanistan ‘to prevent immoral activities’

England striker Harry Kane exploited error-prone Chelsea to score twice in Bayern Munich's 3-1 Champions League win.

England striker Harry Kane exploited error-prone Chelsea to score twice in Bayern Munich's 3-1 Champions League win.

Holders Paris St-Germain made the perfect start to the defence of their Champions League title with an emphatic win against Atalanta.

Holders Paris St-Germain made the perfect start to the defence of their Champions League title with an emphatic win against Atalanta.

Atletico Madrid manager Diego Simeone regrets clashing with Liverpool supporters at the end of their dramatic Champions League opener at Anfield - but says they were sparked by "insults".

Atletico Madrid manager Diego Simeone regrets clashing with Liverpool supporters at the end of their dramatic Champions League opener at Anfield - but says they were sparked by "insults".

King and Trump hail UK-US special relationship in state banquet speech

King and Trump hail UK-US special relationship in state banquet speech

W’Cup Qualifiers: South Africa absent from FIFA sanction list

W’Cup Qualifiers: South Africa absent from FIFA sanction list

Texas billionaire who loves subprime auto loans next to buy NBA team

Texas billionaire who loves subprime auto loans next to buy NBA team

Benue varsity clears promotion backlog, 146 Lecturers get Associate, full Professorship

Benue varsity clears promotion backlog, 146 Lecturers get Associate, full Professorship

Cristiano Ronaldo will play on with Portugal for 'as long as he wants' with Roberto Martinez confident 40-year-old striker can lead the team at 2026 World Cup

Cristiano Ronaldo will play on with Portugal for 'as long as he wants' with Roberto Martinez confident 40-year-old striker can lead the team at 2026 World Cup

Lagos market massacre: Death toll rises after police shooting

Lagos market massacre: Death toll rises after police shooting

OFFICIAL: 420 communities attacked in Plateau, almost 12,000 killed in 24 years — Fact-Finding Committee

OFFICIAL: 420 communities attacked in Plateau, almost 12,000 killed in 24 years — Fact-Finding Committee

Heavy mourning as FIRS loses 4 senior staff in Lagos fire (SEE NAMES)

Heavy mourning as FIRS loses 4 senior staff in Lagos fire (SEE NAMES)

Marketers demand N1.5trn subsidy to match refinery gantry price — Dangote

Marketers demand N1.5trn subsidy to match refinery gantry price — Dangote

Pension arrears: Obi slams FG, demands immediate payment to senior citizens

Pension arrears: Obi slams FG, demands immediate payment to senior citizens

2027: APC not scared of Jonathan — National Chairman

2027: APC not scared of Jonathan — National Chairman

Thursday, September 18, 2025 8:56 AM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025