NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.
Na wa for dat kind rain wey fall for Lagos yesterday Monday o. I sure say di rain use vex fall becos e don dey struggle to fall since, e no fit. Dem say na hold dem been dey hold am tele tele make e no fall.
Dat yesterday morning, we just finish our Union meeting wey we discus how we go take work with Sanwo Olu wey wan take Ambode place so. Dem talk say wen Lagos talk, Sanwo Olu answer. Se wen e enter, im go also answer we taxi driver? Na wetin we discus for dat meeting be dat.
As all of us just say Amen for di pray wey Jimoh(our chairman) and Idowu(treasurer) pray to end di meeting, na im we just dey hear one kind loud noise like dat. I first tink say weda na helicopter fall for our garage.
All of us nearly run. Na later we see say na heavy wind dey blow. Small time everywia come turn to night - very dark - for 8 o'clock a.m in di morning o. Tori Olorun!
Di next ting be say, rain don start be dat. Di kind rain wey fall dat yesterday morning, I never see since I run comot for my village for Ogbomosho come Lagos.
Di rain scata everywia, everybody dey run kati kati to go take cover for under bridge wey dey near our garage.
Before you open your eye sef, rain water don full for gutter trowey. All di road come turn to river. Olorun Oba o! And we hear say, as e be for Ikeja, na so di hole Lagos be.
Tank God say we hold dat meeting for our garage dat yesterday morning. If dat kind rain catch me for road, how I for do with my guonguoro nah.
People wey dey road hear nwi for dat rain, I swear! Plenty people nyansh open, no be small. All dose motor wey dia body dey shine like say na tear rubber, dem drink water for road sote dem peme inside.
Okada nko? Dat one na anoda matter entirely. Flood carry plenty okada for Ikeja go trowey for Lagoon.
One sisi like dat fall inside di rain water and carry im two leg up. Na dat time everybody see say everyting for di sisi body na fake - hair, nyansh, breast, nail - all na fake! Everyting na padded. Come see as all dose agbero laugh am. Di sisi come dey cry.
Di only ting wey disturb me for dat rain na cold wey enter my body. I come dey tink how I go just take my guonguoro enter di rain rush go meet my wife Bose for house.
But no road. If I make mistake put my guonguoro for inside dat River Ikeja, my nyansh sef for open.
Make we jam again on Friday.
Tank you.
Tank you very much.
And tank you very, very much indeed.