NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.
Wen Aisha give Sikiratu anoder blow for face ppuuaarrhh, di crowd wey gather shout “Ehhh!!” As Sikiratu reply with double blow ppuuaarrhh! ppuuaarrhh!!, di crowd shout “One kpondo!”
I no come know wetin make I do. I look back to see weda any of our Union member dem dey around wey go helep me stop dis war, for wia! All of dem don enter dia taxi, drive comot for garage. Tori Olorun!
One old Baba and im wife enter garage dat very time to come take drop go somewia. As di Baba enter, na dat time di fight come hot pass.
Dat time, Sikiratu don tear Aisha clothe come remain only pant and bra. All di bobo wey dey for dia dey try to push and come close make dem look di yellow G-string wey Aisha wear.
By dat time, Aisha sef don bite Sikiratu for nyansh, sote blood dey come out.
Di Baba shout: “What is going on here?” Nobody mind am. Di fight dey hot dey go and di crowd dey cheer dem.
Baba collect phone for Mama hand, I see as e make call. E no reach five minute, come see Hilux van wey carry full load of olopa with gun from Area F arrive.
Di olopa dem begin shoot tear gas as dem see di crowd and di fight. Dat time, di Baba and Mama don comot one ting like dat for dia bag take cover dia nose make tear gas no affect dem.
Come see as everybody run kati kati. As di olopa dem see Baba and Mama, dia oga shout, “Tion for officer everywhere!” All of dem tanda for attention, nobody shake body till di Baba come tell dem “Easy!” Na dat time all di olopa dem come salute di Baba and Mama.
Na later I come hear say di Baba and Mama – husband and wife – na commissioner of olopa for Abuja tele tele but dem don retire.
I hear wen di Baba tell di olopa oga say im been come to take taxi for drop go airport to travel go Abuja wen e meet di fight. E say make di olopa carry di two sisi dem go dia station go ask dem wetin go make dem fight like dat, sote dem tear dia clothe for motor park.
Aisha wan explain wetin happen, na im di oga olopa shout for im head say make e keep im mouth for permanent condition of shut up till e reach for station.
As olopa push Sikiratu and Aisha enter dia Hilux van, na im me sef find my way. If di two both of dem mention my name, na wetin I go tell olopa?
Dat’s why, since dat Monday wey di Iraq and Iran war shele, I no show face for garage.
If anybody ask of me, tell di person say I no dey house, I don travel.
Make we jam again on Tuesday.
Tank you.
Tank you very much.
And tank you very, very much indeed.