NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.
Na wa for Lagos o. If any Lagos sisi target any man, if di man no strong, na im be say di man must to ready for war be dat.
If you like make you be anoder person husband or papa, if Lagos sisi target you like dis, just know say if Eledumare no tanda with you gidigba, you must to fall.
See like wetin happen yesterday for our garage wey dey for near Ikeja under bridge, di ting pass Iraq versus Iran war wey shele dat time.
Di kind rain wey fall dat morning no be small ting o. As di rain dey fall, di hole of dat our garage area just turn to River Ikeja, no road to pass.
Na im me and my order Union member dem just siddon dey nack tori.
Wen di rain come stop, e take anoder two hour make di rain water for road dry. Na as we dey wait make di water dry, na im Aisha enter garage with im market.
Una kukuma sabi say di order day wen di mobile buka girl come sell ewa agoyin for our garage, e been declare before everybody say na me be im love, abi na lust (according to Jimoh, our branch chairman).
But me I sabi say na jealousy dey worry Jimoh dat day. After all,
weda na love or na lust, all na di same ten and ten pence. Na di same mama born di two both of them – love and lust. Simple!
As Aisha come again yesterday, e first come trowey kiss for me for air, piom. And me sef catch am double – piom, piom.
All of us for our garage like ewa agoyin and Agege bread. Dat combination na solid rock. If you chop ewa agoyin with Agege bread, den come use pure water tutu wash am down, na im be say you don lay foundation for your belle be dat for di rest of di day. You go fit drive from here to Jericho, no wahala becos your belle dey kampe.
If you see di kind special Agege bread wey Aisha bring for me, torin Olorun! One person no fit finish am lai lai! I sure say dat Agege bread na imported.
As all of us for garage dey chop, na im Aisha come siddon with me, e come dey feed me for mouth like baby.
As Aisha cut di Agege bread again to put for my mouth with anoder batch of ewa agoyin, na im Sikiratu enter garage.
Sikiratu stop, e shout "Chisos!" wen e see as Aisha dey give me food for mouth. Na so I form emergency cough.
Aisha say, "sorry darling, make I bring pure water tutu for you."
Sikiratu shout, "Stop!!! Wetin you call my Oga MAT? Darling ko. Make I no hear am for your mouth again o!"
Aisha ask me, "Honey, na who be dis wey come disturb our...?"
Aisha no talk finish wen I hear puuuaaaarrrh!!! Sikiratu don land Aisha one dirty slap for face be dat. And na so Aisha wake up and land Sikiratu double dirty slap, ppuuaarrh, ppuuaarrh!!! Fight don start be dat o. Olorun Oba o!
Instead make our union member dem helep seperate di fight, dem escape one by one, e come remain only me with di two fighter sisi dem.
Trust Lagos people, small time crowd don gather for our garage, dey watch di Iraq versus Iran war...
(To be continued)
Make we jam again on Friday.
Tank you.
Tank you very much.
And tank you very, very much indeed.