NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.
Di kind tori wey newspaper, TV and radio dey carry now for dis our Naija don dey make afraid catch man pikin.
Everyday, na so so kidnap and gbomo gbomo news we dey hear.
And dis our taxi driver work get as e be. Na orisirisi passenger dem we dey carry everyday - di good, di bad and di... (BAT, OBJ, Timaya. Chuus one and fill in di gap. But my hand no dey dia o).
Dat's why I don dey tink how I go take fix machine wey I go take dey scan any passenger wey I wan carry.
Una kukuma sabi say our own no be like BRT, Lagbus, Danfo, Molue or Bolekaja wey dey carry plenty passenger dem. Our own na charter or drop. Na di taxi driver and passenger only.
As dat wicked Arike papa for my village don peme - di man wey wan take juju finish me for Standard Five say I give Arike im pikin belle, di man wey make me run comot for my village Ogbomoso come do mecho work for Lagos before I begin do dis my taxi driver work - I wan travel go my village since after 59 years ago wen I run come Lagos.
Na only God know weda I go still sabi di road go my papa house. But I must go becos wetin I dey go for dey very important.
I wan go meet beta Baba make e do African Insurance for me. I for do am for Lagos but fake Baba dem too plenty for Lagos. Na village product still be original.
I wan go do di kind one wey be say, if any passenger carry bad ting for mind, e go appear like dat oyibo mirror wey dem dey call CCTV. And if any passenger carry gun, di gun go peme as di passenger just enter my guonguoro.
Na di original bullet proof be dat. No scan or Insurance pass dat one, and I must travel go village go fix am for my guonguoro kia kia.
Make we jam again on Friday.
Tank you.
Tank you very much.
And tank you very, very much indeed.