Dat May Day parade sweet, no be small. If you see me for action dat day, you no go ever believe say na Oga MAT you see so. I swear!
Di day before dat Wednesday, our Union give us waiting we go wear on May Day – white T-shirt, green fez cap and green trouser.
For morning, I don wake up early, iron my uniform and take am nack for body. By 7 O’clock a.m. in di morning, I don jump inside my guonguoro, begin go our garage wey dey for near Ikeja under bridge.
Before 8 o’clock a.m dat morning, all our union member dem don complete for garage with dia uniform. Na for garage we charter bus begin go Agege Stadium for di parade.
Come see orisirisi sisi and bobo dem for di stadium. Some bobo dem tall trowey, some dey down to earth like our second oga for Aso Rock and oga wey dey Kaduna. Very, very down to earth! Some of dem carry gotie bie bie, and some, dia face smooth like bottle.
Di sisi dem nko? Na dose one plenty pass. Come see some of dem wey carry over load for dia chest and some for dia backyard. Na real Dunlop Elite! Some of dem be like conquer mixture - dia face yellow like yellow fever, dia hand black like charcoal. My broder, cloth dey cover orisirisi tings for dis world, no be small.
But wetin I notice be say, plenty of di bobo and sisi dem na ashewo dem come do for stadium dat day. Go any corner, you must to see bobo and sisi in some wicked position. And plenty of dem don marry o. Tori Olorun!
Wetin concern agbero with overload? Apart from how we march like soja dem make Oga Ambode take salute, anoder ting wey sweet me pass na wetin Oga Ambode talk. E talk say im don ready to pay 30k minimum wage. And I hear say na di same ting wey oga patapata for Aso Rock and order oga dem for order state dem talk.
But di ting be say, na only dia worker dem, dem dey plan to pay di minimum wage. Na im make I just dey laugh dem since dat May Day. Se na only people wey dey do gofmen work be worker? We taxi driver nko, no be work we dey work?
Dat's why we gree for our union meeting yesterday say make everybody open im ear, im nose, im eye and even im nyash join am, any day we hear say dem don begin pay minimum wage, we must to get our own. Na dat very day money to charter taxi or take drop go anywhere to double. Yes nah.
Abi, who no want collect minimum wage?
Make we jam again on Tuesday.
Tank you.
Tank you very much.
And tank you very, very much indeed.
NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.