ADVERTISEMENT
ADVERTISEMENT

Aisha my lust!

News Express |30th Apr 2019 | 2,844
Aisha my lust!

My wife Bose don kukuma talk am tele tele say dis our taxi driver work na ashewo work. And I gree with Bose intoto.

Yes nah. For dis our work, you go see orisirisi passenger dem everyday. And plenty of di passenger na we di driver be dia target.

You know say na Drop we yellow taxi dey carry - only you and di passenger. Some of di woman passenger go begin tune you as una dey go, and if you make mistake carry di bad one for night, hmm, na only Eledumare go helep you make di sisi no rape you in motion.

Even wen you no dey in motion, all dis Lagos sisi dia eye dem still dey for we taxi driver body.

Even as I old reach, and with all di plenty mark wey my papa and mama take tear my face wen dem born me, Lagos sisi dem no let me rest. Na only God know wetin dem see for my body. Tori Olorun!

See like di order day, passenger dem no gree show face for our garage wey dey for near Ikeja under bridge. Me and my union member dem relax, dey play draft.

Jimoh - our union branch chairman - dey smoke im igbo. Idowu, our treasurer, Akpan plus including Emeka dey shack dia monkey tail. Me, di union akowe, dey nurse my small Alomo as My Usual no dey near.

Na so we just dey relax, dey play our draft o wen one mobile buka sisi like dat come for our garage.

Na Akpan first notice di sisi. E ask di sisi wetin e dey sell, di sisi say na Ewa Agoyin plus Agege Bread e dey sell. Akpan helep di sisi to bring di market down from im head. Na so all of us buy di mobile buka food begin dey eat.

As we dey eat, di sisi wey don take hijab cover im head just tanda dey wait make we chop finish make e collect im plate and spoon wash.

Jimoh ask am wetin be im name, di sisi say im name na Joy. Idowu say “Joy ko, Mary ni”. E say weda e don see wen Joy wear hijab before. Di sisi smile, den look my face ti-ti-ti-ti. Me I comot my eye trowey for di order side, dey deal with my Ewa Agoyin and Agege Bread plus pure water to take wash am down.

Wen all of us don chop finish, every body pay. But wen e reach my turn to pay, di sisi take eye signal me make I no worry. I no understand.

As di sisi wan begin go, Akpan wan helep am again carry di mobile buka put for di sisi head, di sisi say make Akpan no worry.

Na im e use eye signal me make I helep am carry im market put for im head. I helep am. Our order union member dem come jealous.

Akpan tell am say me I marry four wife and I get 10 pikin. Di sisi no mind am. Emeka ask am wetin e wan take old man like me do, di sisi just smile. Idowu tell am say my taxi na guonguoro, say im own taxi na chassis. Di sisi no mind am.

Jimoh come tell di sisi say na only im fit give am love, say wetin me I go give am na lust becos I get girlfriend full every wia for Lagos.

Na dat time di sisi come smile, e tell dem say all di ting wey all of dem talk, na dem sabi. E say na me im love. Jimoh say na lust. Di sisi say weda na love or na lust, all na di same ten and ten pence.

Di sisi use one hand hold im market for im head, take di order hand hold my hand. E say make I escort am reach under Ikeja bridge. Our union member dem wan peme.

Wen we dey go, di mobile buka girl tell me say im real name na Aisha. E say e go come our garage again next week with im market as dat day na Saturday.

Since dat day, my mind no comot for Aisha my love...sorry...Aisha my lust!

Make we jam again on Friday.

Tank you.

Tank you very much.

And tank you very, very much indeed.



Comments

Post Comment

Sunday, June 22, 2025 6:15 AM
ADVERTISEMENT
Over 70 years Shell banner
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025