NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.
E dey some tings wey person go talk, everybody go squeeze face and begin blame di person wey talk am.
My broda, di kind ting wey happen to me yesterday wey be Easter Monday, I dey shame to tell anybody.
I nearly enter troublem dat yesterday. I just say make I use style go Madam Shine buka wey dey for near Airport Hotel for dat Ikeja wey our garage dey.
As I enter di buka, na im Sikiratu come meet me. E say as I don land so, im no go serve any order customer again dat day, e say na me and im for dis Easter.
Even im madam, Madam Shine, tell Sikiratu make e go wash plate make dem take am serve customer pepper soup, Sikiratu tell im madam korokoro say e don close for di day, as im man (me o) don land so.
Trust Madam Shine nah, any time I dey for dia, e no dey trouble Sikiratu, but di ting be say e dey use style obtain me, big time!
Before I know it, Madam Shine don shack four bottle of Odekun for my head. Tori Olorun!
Sikiratu say make I no worry, e open im purse, bring out money and pay for di two bottle of “My Usual” wey I take. E also pay for di Coke wey e drink, plus including di four Odekun wey im madam consume.
I ask Sikiratu wey e see dat kind money, e say why I ask am dat kind question, weda I no be im sugar boy. E say na Easter e dey do for me. Chaaaiii!!!
Di next ting be say, Sikiratu carry im bag, e say make we dey go. Before I open my mouth to ask am wia we dey go, Sikiratu don stand up, go jump inside my guonguoro.
Na im me sef go meet am for dia. Sikiratu say make we find place wey only me and im go dey togeder for dat Easter Monday. I ask am which place e get for mind, Sikiratu say make we just comot for dat place, dey drive dey go till we see any joint.
Na im I put my guonguoro into action, begin drive dey go for Agege Motor Road. We come dey go like say we dey go Oshodi.
As we reach Shogunle bus stop, I drive enter di street for right, na im we see one Short Time joint. I branch. We come see say crowd full for di street gan, dem come cause Go-slow sef.
As I park make we come down, I hear person tap my own side of di door of my guonguoro pom, pom, pom. I look up to see who dey knock with dat kind udacity. Na my wife Bose!
(To be continued)
Make we jam again on Friday.
Tank you.
Tank you very much.
And tank you very very much indeed.