ADVERTISEMENT
ADVERTISEMENT

Me sef want begin drive Uber

News Express |12th Apr 2019 | 3,160
Me sef want begin drive Uber

  E be like say gofment for Lagos State don dey take style drive we yellow taxi driver comot for Lagos road.

If no be so, why dem go first bring BRT and Lagbus? After dat, dem bring Uber, den Taxify. E no finish for taxi o.  Dem enter okada sef. Now, dem don bring Maxokada and Gokada.

All dis new transport don carry all our passenger dem go. Na so we go siddon for our garage wey dey for near Ikeja under bridge dey play Draft from morning till night everyday - no passenger.

Tings never be like dis since I begin drive dis my guonguoro.  If na like dis e be dat time wey I do freedom for mecho work, den come enter taxi driver work, I for no marry till now, talk less to born my two woman pikin – Bisi and Funke.

And di kind tings wey we yellow taxi driver dey take our mouth see for road now, our eye no fit talk am.

If you make mistake see one passenger carry for drop, na so all dis people with orisirisi uniform go do toll gate every corner for road.

E remain make Boys Scout and Boys Brigade dem dey tanda for road dey collect toll gate. But dem no dey do like dat with Uber people and dia broda dem o.

Na im make I don dey do Alajo to take save money wey I go take buy new phone. I go trowey dis my chinko torch light phone buy di one wey dem dey touch screen pra-pra-pra. After all, na wetin be Uber if no be phone?

Noting do my guonguoro. If e too bad, I go buy new engine put, panel beat di body and change colour. After all, Uber no better pass my guonguoro. Di only ting wey I no get na AC.

 No be say my guonguoro dey forbid AC o, di ting be say AC too dey drink fuel. But dat one no mean say wen come turn to become, man no go fit shake body.

My people, dis matter na serious matter o. Wen una hear say I don turn my guonguoro to Uber, make una no surprise. Dis Uber people don oppress us tire Dia shakara don dey too much.

I say again, na wetin dey for Uber sef pass phone?  Wen I buy new phone, Uber don shele be dat nah. Abi no be so?  Na Sokoto sef.

Make we jam again on Tuesday.

Tank you.

Tank you very much.

And tank you very, very much indeed.



Comments

Post Comment

Friday, September 20, 2024 9:37 AM

Follow us on

ADVERTISEMENT

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2024