ADVERTISEMENT
ADVERTISEMENT

Me sef do TraderMoni for my passenger dem

News Express |2nd Apr 2019 | 3,208
Me sef do TraderMoni for my passenger dem

On Saturday, I say make I rest small for house before I go our garage wey dey for near Ikeja under bridge.

My wife Bose wake me up around 5 O’clock a.m dat morning. E ask me weda I no want go work wey I come sleep till dat time. I tell am say I want rest small, say I go comot for house go garage around 9 O’clock a.m. in di morning.

As I just answer Bose finish, na im my second woman pikin, Funke come knock for bedroom door to ask me weda I no want go work. I tell am di same ting wey I tell im mama.

Small time, my first woman pikin Bisi come ask me di same question, and I give am di same answer.

Na so me and my wife dey for bed till 9 O’clock a.m. dat morning. We dey do straight sleep and bend bend sleep at di same time.

Wen we comot for bed, our belle sweet no be small. If you see di kind breakfast wey Bose serve me dat morning before I comot for house, hmmm, you go tink say na oyibo want eat am. I sabi say my wife use am to compensate me for a job weldone dat morning. Yes nah.

Me sef, as I drive my guonguoro dey go for our garage, my belle sweet me well well. I just dey sing orisirisi church song and na so I just dey smile upandan. Who talk say to marry better wife no sweet? I mean wife wey sabi wetin dey o!

I reach garage, park my guonguoro and come down, I still dey sing, dey smile, sote I come dey clap hand join sef.

Na Jimoh, our union chairman, first notice my sweet belle. E ask me weda I don win NaijaBet. I tell am say wetin I win pass NaijaBet.

Noting wey Jimoh and our order union member dem no do make I tell dem wetin make all my body sweet me like dat for dat Saturday morning. But na lie, I no fit tell dem.

Tell dem what? Tell dem say me and my wife do bend bend sleep dat morning? Dem wey marry wife full di hole Lagos, dem dey tell me dia own tori?

Becos of how I happy, I dash all di passenger wey I carry dat day 50 per cent discount. And na so all my passenger dey tank and pray for me troughout dat Saturday.

But I no call am TraderMoni, I call my own PassengerMoni. Weda or wedan't I go continue after dis time out, I no fit answer.

Make we jam again on Friday.

Tank you.

Tank you very much.

And tank you very, very much indeed.



Comments

Post Comment

Friday, September 20, 2024 9:32 AM

Follow us on

ADVERTISEMENT

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2024