NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.
Dat promo wey I do last Friday no be small ting o. People wey do di promo nearly pass Saturday election people sef.
Come see as people rush to answer di 10 question wey I trowey for ground. Na so WhatsApp message just dey pour inside my Oga Grandmaster Sunny Okim phone per second per second.
I no kukuma get WhatsApp for my phone. Na only torchlight my chinko phone get.
But una sabi say upon all di plenty people wey answer dose question dem, no be everybody go win nah.
Di true ting be say, out of 313 people wey answer di 10 question dem, only two person get all (10) correct.
For dis promo, I no go suspend or cancel or postpone result, talkless of to rig am. My own promo na free, fair and credible. If na lie I talk, make I baf naked for bafroom.
First, make una see di correct answer to di 10 question dem:
1. Wetin be Oga MAT wife name?
Answer: Bose
2. Who be Oga MAT landlord?
Answer: Baba Braimoh
3. Oga MAT garage dey for Ojota. True or False?
Answer: False
4. Wetin be di full meaning of MAT for Oga MAT?
Answer: Man About Town.
5. Oga MAT na di secretary of taxi driver union for dia branch. Who be di treasurer?
Answer: Idowu
6. Wetin be di name of di town and state Oga MAT come from for dis Naija?
Answer: Ogbomoso, Oyo State.
7. E get one buka girl wey im and Oga MAT na five and six. (a) Wetin be di name of dat sisi? (b) Who get di buka wey di girl dey work?
Answer: (a) Sikiratu (b) Madam Shine.
8. How many pikin Oga MAT get and wetin be dia name?
Answer: Two pikin dem – Bisi and Funke.
9. Why Oga MAT run comot for im village come live for Lagos?
Answer: Arike (Oga MAT classmate for dia village night school) talk say Oga MAT give am belle and Arike papa want take juju finish Oga MAT.
10. Which work Oga MAT first learn for Lagos before e begin drive taxi?
Answer: Mecho work.
Una see say di question simple and di answer over simple?
RESULT
*10 correct answer – 2 person only
*9 correct answer – 101 person only
*5 correct answer – 115 person only
*4 correct answer – 90 person only
*2 correct answer – 5 person only
Total accredited person – 313
Void person – 0
WINNER DEM
*Dauda Folorunsho – N1500 Airtel recharge.
* Princess Chidi – N1500 MTN recharge.
Una do well, my belove broda and sista.
Sebi una see say ojoro no dey for dis my own promo.
Tell me, me and INEC, na who neck dey pain?
Make we jam again for Friday.
Tank you.
Tank you very much.
And tank you very, very much indeed.