ADVERTISEMENT

Answer and Win Promo

News Express |8th Mar 2019 | 3,490
Answer and Win Promo

Everywia for Naija, na so so promo man just dey see. Do dis and win, do dat and win, na im you go see every wia.

Me wey dey do dis my taxi driver work, na promo I dey see any corner I carry passenger enter for Lagos.

Go to market, na promo. Go to school, na promo. Waka enter church and mosque, na di same ten and ten pence. Look sign board wey full for road, na orisirisi promo you go see. Tori Olorun!

And di ting be say, plenty of dem na 419. You go answer all di question wey dem ask you finish, make dem give you di prize wey dem promise, na dat time you go begin hear tori.

Dat's why I say me sef fit do correct promo for my people, no be fake one. Me I no go promise una motor or house or land for Lekki. My own prize na wetin I sabi say I go fit release for anybody wey fit to answer all di question.

I know say na data una dey use read my sweet sweet tori wey I dey nack una, so I go buy di winner data wey go last you for one full month, any line wey you like.

My question no hard, but make sure you no sort o, becos if I catch you, hmm, na EFCC straight!

Today na me be teacher. Answer di following question:

1. Wetin be Oga MAT wife name?

2. Who be Oga MAT landlord?

3. Oga MAT garage dey for Ojota. True or False?

4. Wetin be di full meaning of MAT for Oga MAT?

5. Oga MAT na di secretary of taxi driver union for dia branch. Who be di treasurer?

6. Wetin be di name of di town and state Oga MAT come from for dis Naija?

7. E get one buka girl wey im and Oga MAT na five and six. (a) Wetin be di name of dat sisi? (b) Who get di buka wey di girl dey work?

8. How many pikin Oga MAT get and wetin be dia name?

9. Why Oga MAT run comot for im village come live for Lagos?

10. Which work Oga MAT first learn for Lagos before e begin drive taxi?

Send your answer for WhatsApp, plus including your name to: 08023293993.

Your time begin NOW!



Comments

Post Comment

Thursday, September 18, 2025 4:20 AM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025