ADVERTISEMENT
ADVERTISEMENT

I don dey pack my load small small ... to enter Aso Rock!

News Express |26th Feb 2019 | 6,525
I don dey pack my load small small  ... to enter Aso Rock!

Dis INEC people na winch o. Dem tink say dem fit delay my destiny, na lie dem dey talk. My destiny na to enter Aso Rock, weda or wedan’t INEC like am.

Di order Saturday, na so dem talk am say no election again, and na for mid night wen everybody don sleep o.

Last Saturday again, we line up, vote finish, to tell us who win come be troublem. Which kind ting be dis nah. Abi dem send dis INEC to come kill people finish with high blood?

Since Saturday, dem just hang everybody mind for up. After, dem say dem go announce result on Sunday 6 O’clock pm in di evening.

I enter road with my guonguoro dat Sunday morning. Na only me dey for our garage wey dey near Ikeja under bridge. All our union member dem siddon for dia house, dey look television anya anya, make INEC announce result. For wia!

I siddon for garage from morning till night, I no see one passenger carry. Everybody dey for house dey wait for result.

Na im I begin go my house wey dey for Abule Egba. Na dat night INEC come talk say dem go announce di result on Monday (yesterday) by 11 O’clock a.m. in di morning.

Na so everybody siddon for house again, dey wait for INEC – 6 O’clock a.m. in di morning nack, 7, 8, 9, 10, 11, 12... till night again, INEC no gree talk. Tori Olorun!

But di only ting wey I see for dis ting be say, plenty prophet dem wey dey dis Naija na cash and carry prophet. Una remember say some of dem been talk say God tell dem say na Buhari go win, some of dem say na Atiku. Now some of dia nyansh don open. I sure say plenty of dem, dat dia wayo business go fold up.

Well sha, dia vision no affect my own wey pastor see for me for my wife, Bose dia church dat Cross Over night. Abi una don forgot?

Di Man of God talk say na me go be Chief Driver for Aso Rock.

So, e no concern me di person wey INEC announce. Wetin I sabi be say, I don ready to move enter Aso Rock any moment from now. Dat's why I don dey pack my load small small.

Make we jam again on Friday.

Tank you.

Tank you very much.

And tank you very, very much indeed.



Comments

Post Comment

Friday, September 20, 2024 6:42 AM

Follow us on

ADVERTISEMENT

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2024