ADVERTISEMENT
ADVERTISEMENT

I wan do my birthday party

News Express |5th Feb 2019 | 3,687
I wan do my birthday party

Di kind way people dey take spend money for dis our contry, you go begin wonder why people dey talk say money no dey for di contry. Me, I believe say money dey repete, only be say di money dey for few people hand, e no circulate.

Since wen we go for Jimoh, our union chairman birthday party on Saturday, I dey wait for anybody wey go come tell me again say money no dey dis our contry, make I bend dat person mouth go back.

Na last Friday Jimoh tell us for garage say di next day na im birthday. E say im just wan make we, im union member dem, come im house around 5 O’clock pm in di evening dat Saturday, make we siddon togeder, drink, chop and pray to tank God as e make am 65 year old. E say im no invite plenty people, only dose wey dey very close to am.

Dat Saturday I no just reach our garage wey dey for near Ikeja under bridge. I say make I rest small for house with my family. No be every day man go dey for road, after all, body no be wood.

As time just nack nack 4 o'clock pm dat evening, I rush go baf. I tell my second woman pikin Funke, make e go wash my guonguoro, say I wan drive am go for my union chairman house for Mushin.

Bose my wife wan give me food, I tell am say make e no worry, say no how, no how, Jimoh must to serve food for im place.

Na im I wear my shokoto trouser and jumper, den come top am with agbada and cap. I appear as complete Ogbomoso man dat day. I look time, 4.30 o'clock pm don nack. I say make I begin dey go, I sabi say from my house for Abule Egba, go reach Jimoh house for Mushin, patapata e go take like 30 minute if go-slow no dey.

As I reach Olorunshogo bus stop, to branch enter Jimoh street, every wia don block. No road for motor to pass. Na LASTMA officer dem come dey control traffic, dey show people how dem go take park dia motor.

I ask one LASTMA officer wetin happen make di hole area block like dat, e say na one Baba wey be Taxi Driver Union Chairman for Ikeja dey do birthday party. I come talk am for my mind say weda na Jimoh party go make everywia block like dat.

I park my guonguoro, come begin dey trek like six street before I reach Jimoh street. As I just enter Jimoh im street like dis, Torin Olorun, di ting wey my mouth see, my eye no fit talk am.

Come see people plenty like sand sand. Jimoh don block di hole street with canopy. Orisirisi band dey play -Juju band dey, Fuji band dey, Apala music band sef reach like four. All of dem dey play at di same time, and na so people dey dance, dey spray money yanfu yanfu like say tomorrow no dey.

To waka reach wey I go siddon take like 25 minute. Wen di sisi wey dey do usher carry me reach di table, I see say na di table for our union member dem be dat – Akpan our Social Organiser, Idowu our Treasurer and all our union member dem complete for dia. Dem dey drink, dem dey chop, dem dey dance. Wen dem see me, all of dem come shout: Oga MAT welcome! Welcome Oga MAT!! Our able Akowe welcome!!!

Na so dem come give me my seat.

(To be continued)

Make we jam again on Friday.

Tank you.

Tank you very much.

And tank you very, very much indeed

Comments

Post Comment

Friday, September 20, 2024 3:33 AM

Follow us on

ADVERTISEMENT

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2024