ADVERTISEMENT
ADVERTISEMENT

My pikin want marry oyibo

News Express |22nd Jan 2019 | 3,740
My pikin want marry oyibo

I no just understand wetin dey happen for dis our contry again. Everybody dey for strike. And di one wey no dey, dey plan to begin dia own strike any time soon.

See like teacher dem wey dey teach for university, dem don begin dia strike tipe tipe. Since last year dem siddon for house, no work. Na only God know wetin dem dey find for gofment hand.

Before, before dem dey talk say teacher reward dey for heaven, but now teacher no want wait to get dia pepper for heaven, dem want am now, now, now. You blame dem?

Na so all dis school pikin dem dey waka for street everyday, from morning till night. Some of dem don join bad gang, and I sure say plenty of di woman pikin dem no go fit go back school wen di strike finish, becos dem go don carry belle.

Dose school pikin dem wey manage pass di almighty JAMB last year, dem no fit enter school till now, and di ones wey want take JAMB dis year, dem no even know which time dem go enter school, all becos of strike.

Dem say dia name na ASUU. Why dis ASUU people wicked like dis? Why dem go take dia own wahala put sand sand for anoda man garri? Why? I say why?

See my first woman pikin wey I give money di order day make e take enter for JAMB. Yesterday, wen I reach house for night, I don tire patapata. Bisi no even let me park my guonguoro well, na im e come meet me, e say e get wetin e want tell me. I tell am say weda dat ting wey e want tell me no fit wait till I enter house, baf and chop finish. Bisi say di ting dey very urgent and e no fit wait.

Na so Bisi enter passenger seat for front of my guonguoro, e begin tell me say e get one fine broda like dat wey want come meet me in di morning.

I ask am who be di broda and wetin e want come meet me for. Bisi say di bobo na im friend, but e no know why di broda want come meet me.

I ask am weda e don tell im mama, e say na im mama e first tell. I ask am wetin im mama talk, e say im mama say if I gree, im sef don gree. I ask am wetin be di broda name, e say na oyibo.

Oyibo?  Hmmm.  I tell Bisi say no troublem, make e tell di oyibo make e come by 7 o'clock a.m in di morning before I enter road.

Dis morning, na im I hear pom, pom, pom for door. I check time, na 7 o'clock a. m sharp. I just baf finish,  I dey wear my shokoto trouser for room wen Bisi rush come tell me say di oyibo don come. I tell am make e let am enter for parlour siddon wait for me.

As I just enter parlour, come see who dey wait for me!

I ask Bisi weda na di oyibo be dis, e say yes. I ask di bobo wetin e find come , e say e want marry my pikin Bisi.

Na im I give Bisi one dirty slap for im face ppuuaarrrhh!!! If no be say im mama and im junior sister hold me, I for cut Bisi ear comot.

So becos of ASUU strike, my pikin want marry afin wey dey do agbero work for Mile 12!  Tori Olorun!

As I rush enter room come out,  no be person tell dat useless agbero to run comot for my house. Marry ko, divorce ni.

Abeg make we jam again on Friday.

Tank you.

Tank you very much.

And tank you very very much indeed.

Comments

Post Comment

Friday, September 20, 2024 1:27 AM

Follow us on

ADVERTISEMENT

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2024