ADVERTISEMENT
ADVERTISEMENT

Cunny man die, cunny man bury am

News Express |11th Jan 2019 | 3,960
Cunny man die, cunny man bury am

New year don come, na so all dis Lagos bobo dem don begin dey hustle for money by force, by fire.

I carry one madam like dat yesterday go drop for Apapa Wharf. Wen I dey come back, one bobo stop me for Costain. E say make I carry am go Mowe Ibafo. E say wen we reach for dia, I go wait for am make e drop di carton wey im carry for im oga.

I tell am say dat one no be drop, na charter. Di bobo gree. I tell am my price, e gree.

E say make I helep am carry di carton wey im keep for road side, make we put am for inside my guonguoro boot. 

Na so I bend down make I carry di carton. My broda, my waist nearly break into two. Di ting heavy like say e pack all di stone wey dey for dis world put inside di carton.

Na so di bobo rush follow me carry di carton put inside di boot. E open back seat and enter. Me sef enter my driver seat. As I open ignition want start, di bobo say wait, wait, wait!!!

Na so e rush open di door and jump down. E beg me make I open di boot and bring out di carton for am, say e want carry am for leg. See me see troublem o. Which kind wahala be dis?  Make I begin carry dat kind heavy ting again? No be me and you!

I tell am say make e drop make I dey go my way, say I no carry am again. Di bobo come kneel down beg me well well. E say im go add money join for wetin we gree before.

Wen I hear dat one, my belle come sweet. Na so we comot di carton for boot. E say im want siddon for front seat, carry di carton for leg. I say okay o. My own na make you pay me my money. Wetin concern me concern wia you siddon? If you like siddon for di roof of di guonguoro, na you sabi.

As we dey go for road, di bobo ask me weda I know why e comot di carton for boot, I say why. E say im no want take chances at all, say di kind ting wey dey for inside di carton, if anybody thief am, im own don finish be dat.

I ask am which kind ting dey for inside dia. Di bobo just open di carton small. Come see someting o! I no know wen I shout Olorun Oba o ooo!!!

(to be continued)

Make we jam again for Tuesday.

Tank you.

Tank you very much.

And tank you very very much indeed.



Comments

Post Comment

Friday, September 20, 2024 1:44 AM

Follow us on

ADVERTISEMENT

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2024