ADVERTISEMENT
ADVERTISEMENT

Uniform na cloth, na tailor dey sew am

News Express |8th Jan 2019 | 3,792
Uniform na cloth, na tailor dey sew am

Xmas and New Year don finish, everybody eye don open. All di gragra wey people dey do since November don stop.

People wey talk say if dem no travel go dia village for Xmas dem go peme, all of dem don come back and na so Lagos road don come full again patapata.

See like dat yesterday Monday wey school pikin dem resume, everwia full, no be small.Come see as people dey rush bus for bus stop, and di bus wey dey for road sef no reach di people lai lai. Dat's why plenty passenger dem come our garage to take drop, some take for charter.

But di ting wey come happen be say, as passenger full for road, na so orisirisi uniform people full too, and all of dem dey check motor particulars.

I carry one bobo like dat go Mile 2.  We comot for garage, say make we pass Anifowose. As we just reach dat Ikeja Club junction, na im Olopa dem stop me. Dem first greet me happy new year, I say same to you.

After dat, one of dem come say make I bring particulars, I bring out my guonguoro particulars give am, complete!

Di Olopa come say weda I be JJC for Lagos wey make me no sabi wetin particulars be. I tell am say di time wey I don begin dey drive taxi for Lagos, I sure say im still dey run around naked for im village.

Di olopa come say why I talk to am like dat, weda I don forgot say im be gofment officer. I say officer ko, recruit ni. E cock gun, carry di gun point for my head like say e wan shoot. Na im dia oga ask am wetin happen, e tell im oga say I insult am.

Di oga come shout for my head, e say why I insult officer wey dey duty with im full uniform. I come tell di oga di ting wey happen. Di oga ask me which taxi park be my own, I tell am say na di garage wey dey for near Ikeja under bridge. E ask me my name, I tell am say my name na Olugbenga, Olutayo Olugbemiro, but people dey call me Oga MAT.

Di oga olopa quick, quick stand for attention and give me full salute. E say whaaaat?  E say so na me be di Oga MAT wey im dey read all di tori wey e dey nack for newspaper? I tell am say na me be dat o.

Di oga olopa come call all im boys wey dey for dia, e say make dem come see Oga MAT o.  Na so all of dem come gather me, dem come dey take selfi with me upandan.

Before we comot for dia, e pass one hour. As we dey go, my passenger just dey look me, e say which kind taxi driver I be wey Olopa dem dey celebrate like dat. E say I be strong man o. I tell am say na God do am o.

From dat Ikeja, go reach Mile 2, we pass orisirisi uniform dem - Olopa, Custom, Road Safety, VIO, Yellow Fever, Maja Maja, LASMA, Soja. E remain make Boys Scout,  Boys Brigade, Man O’ War and Red Cross begin stand for road dey check particulars like say na me send dem make dem go wack dia money finish for Xmas and new year.

But di ting wey I know be say, Abami Eda don talk am tele tele say any uniform na cloth, and na tailor dey sew am.

Make we jam again for Friday.

Tank you.

Tank you very much.

And tank you very very much indeed.



Comments

Post Comment

Friday, September 20, 2024 1:45 AM

Follow us on

ADVERTISEMENT

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2024