ADVERTISEMENT
ADVERTISEMENT

S-I-K-I-R-A-T-U ! (2)

News Express |1st Jan 2019 | 3,207
S-I-K-I-R-A-T-U ! (2)

Dis buka girl no go kill me o.  No wonder my wife Bose don talk am tele tele say dis taxi driver work  wey I dey do so, na ashewo work.  And I gree with Bose intoto.

But dis clone wey Sikiratu clone imsef, take come my house for Xmas day like man, my mind dey tell me say Madam Shine hand dey inside. If no be so, tell me,  for wia Sikiratu go see money take buy face cap, black eye glass, original jeans trouser, one better oyibo T-shirt like dat wey dem write for chest "New York City " and canvas wey only people like Dangote fit wear?

I come talk am for my mind say so Madam Shine dey package im buka girl make I give am belle and marry am? If na so, Bose nko?

But di ting be say, I dey suspect say me sef like Sikiratu no be small. Any time I see am, my mind go dey do jigi jigi like railway. Abi dis girl don give me juju chop?

Our union member, Akpan don talk am tele tele say for Calabar, dem dey call dat kind love juju "Kop no mi" Make e no be say Sikiratu don give me Kop no mi o.

As I see say Sikiratu clone imsef come my house like man dat Xmas day, I tell am make e begin go wait for me for our garage for Ikeja near under bridge. I tell am say I go come carry am for dia, make we find one Joint for town go do jolly jolly togeder for dat Xmas day.

Siki Babe turn im back dey go, I rush go bafroom, come see long queue! E no go better for dis Baba Braimoh face-me-I-face-you house wey we dey live so. Dis Ijebu man wicked no be small. How can e build house, put 21 tenant dem and build only one pako toilet and bafroom for back yard ?

I no fit begin wait, na im I run enter house, wear my shokoto trouser and jumper,  carry my guonguoro key. I tell my family say e dey one passenger wey say make I come carry am for charter go Ikorodu. Bose say sebi I talk am before say I no go work dat Xmas day. I tell Bose say I don change my mind.

Na im I jump enter my guonguoro, put key and open di ignition, di motor no gree start. I check fuel, I see say na full tank. I open bonnet, I check di engine and everywia, no show. See me wey be original mecho o.

Na so I dey for dia dey struggle to start my guonguoro, di ting no gree. I look time, na 7 O'clock pm in di evening already!  I carry phone to take call Sikiratu make I know weda e still dey wait for me for garage, my phone battery don die again!  Tori Olorun!

I come talk am for my mind say so na di result of all di cast and bind wey Bose and im two woman pikin dem do dat Xmas afternoon be dat?  Hmmm,  dis my wife Bose na witch o.

Make we jam again on Friday.

Tank you.

Tank you very much.

And tank you very, very much indeed.

 

Comments

Post Comment

Friday, September 20, 2024 1:45 AM

Follow us on

ADVERTISEMENT

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2024