NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.
Dis my taxi driver work don dey tire me, I swear. I don dey tink of anoda business wey I go do. I for don go beg my main di main man, Oga Sunny Okim a.k.a Di Grandmaster, make I follow am dey do all dis write write, but man pikin no sabi book nah.
Na night school I go for my village for Ogbomoso. I stop for Standard Five, den run come Lagos, come learn mecho work in 1965 becos of Arike. Hmmm, dat girl! Make God forgive am.
See me see troublem o. Me and Arike dey siddon for di same table for class, just becos I dey always follow am talk, di next ting be say Arike say I don give am belle. And Arike papa na babalawo.
If to say I no run comot for village, dat wicked man for finish me with im juju for wetin I no do. If I do, make I baf naked for bafroom. I swear!
Na im I come learn mecho work for Lagos o, before I graduate dey do taxi driver work with dis my guonguoro. Na after dat I see Bose marry. And God come butter our bread with two woman pikin - Bisi and Funke. Na dis my taxi driver work I take send my two pikin dem go school. Now dem wan enter uniservity, abi na wetin dem dey call am? U...uniser...univ... Uni...abeg make una helep me complete am nah. Tori Olorun!
But now, dis work don dey tire me. Every day – for sun o, for rain o - man go dey for road. And di orisirisi tings wey my mouth dey see for Lagos road day and night, my eye no fit talk am.
See like yesterday, everybody just dey run up and down, all becos of Xmas. Passenger full for road but person no fit move becos of go slow. Every wia just block patapata. You fit believe say na only two passenger I carry from morning till night dat yesterday?
One madam come our garage wey dey near Ikeja under bridge, say make I carry am for Drop go Balogun market for Isale Eko. E say e wan go buy Xmas cloth for im pikin dem. I take Police College road, say make I burst out for Maryland, come see baba nla go slow for Ikeja GRA. I manage turn, say make I take Airport road, dat one sef don block.
Na so I chuk head put for Alausa, go pass Seven Up to Oworonshoki, dat one na im worse pass sef becos we spend like four hour on top dat bridge. Una kukuma sabi how IBB bridge long reach.
Wen we enter Island nko? Olorun Oba o! Dat one, go slow catch di people wey waka for leg sef. People dey rush to buy everyting for Xmas – chicken, shoe, clothe, yam, rice, ororo, onions, pepper, salad tings, pot, stove. Na wetin! I come dey talk am for my mind say for wia all dis people dey since?
Na so we just dey go small, small till we reach Balogun market. I drop di madam. I no drive reach Idumota, na im anoda madam stop me. Dat one na so, so load e carry. E be like say di woman go buy all di ting wey dey for dat market. E carry im four pikin go di market sef, plus including im husband.
Dem say dem dey go Ikeja. I tell dem my price, dem gree. To load all di ting wey dem buy for my guonguoro boot nko? Dat one alone take like one hour for inside dat hot sun o. And na so all of dem just tanda dia dey look me as I dey load. Chaai, man don suffer for dis world!
To drive comot for Isale Eko come mainland, dat one na helele. Na for 9 O’clock pm in di night we reach Ikeja!
Wen I drop dem for dia house for Anifowoshe, I just begin face Abule Egba straight. I say make man go rest, after all body no be wood.
Dat’s why I say today o, I no dey go any wia. Turkey dey for house, fowl dey, rice dey, wine and orisirisi drink dey. Me and my family go do Xmas for house.
Di only ting I dey wait for now na evening time wen I go receive call for my chinko phone. Na di only ting wey go carry me comot for house today be dat. Today na today for me and Sikiratu.
Happy Xmas and Mary New Year in advance!
Make we jam again on Friday wen I go nack una di tori of how me and Siki Babe waka.
Tank you.
Tank you very much.
And tank you very, very much indeed.