NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.
Oga producer come tell me say make I report back 7 o’clock a.m. in di morning di next day. E carry me enter im office, bring out one Ghana-Must-Go bag wey dey for under im table.
E bring out plenty money, count am finish and give me. E say make I count am, I tell am say no need. I never see dat kind plenty money before since wen I comot for my village for Ogbomoso 1965 come learn mecho for Lagos before I enter dis my taxi driver work.
I wan put di money for my shokoto trouser, but oga producer say make I count am first. Which year I go take count dis kind plenty money finish? But sha, I begin count am, and na so my hand and my leg, in short, all my body come dey shake like shakespear. E take me like one hour before I count di money finish. N200, 000.00 ! Olorun Oba o!!!
Oga producer come give me paper say make I sign for di money. I tell am say make e give me ink make I do thump print, say na night school I go for my village and stop for Standard 5 before I run come for Lagos.
Wen I finish to count di money, e come tell me say na advance pay be dat, say I go get my balance wen we shoot di cinema finish. I come talk am for my mind say so I go still collect anoda N100, 000! Tori Olorun!!!
I no just near our garage wey dey for Ikeja dat day again. Wetin I wan go do for dia with dis kind plenty money for my shokoto trouser pocket? How much wey passenger dey pay me for drop sef? See me wey no even start di cinema work and dem don pay me N200, 000 advance! I no know say na like dis all dis cinema people dem dey enjoy o.
Bose my wife and my two pikin dem - Bisi and Funke - surprise to see me come back house for afternoon. As I reach, I first tell Bose make e give me chill ice pure water tutu make I drink. As I drink finish, I tell my wife say make e ready to go market go buy tings wey e go take cook better soup and pounded yam. Say for dat soup, e must put bokoto, roundabout, telephone wire, ishon, pomo, eja tun tun, in short, orisirisi eran. Bose, Bisi and Funke just dey look me anya anya. I ask Bisi and Funke how much be di money for dia JAMB and GCE. Dem say na N50, 000 for di two both of dem. I say no wahala. I ask dem weda Baba Braimoh – our landlord dey for house, dem say e dey. I say no wahala, dat all dat insult wey Baba Braimoh and dat im tiny wife dey insult me becos of dis dia face-me-I-face-you house go stop today.
I first bring out di business card wey oga producer give me for im office, give Funke make e hold am for me. I come relax small, smile, den come put hand for inside my shokoto trouser, come dey bring out di money, bundle by bundle, like Ganduje, put am for center table.
Come see as my wife and pikin dem open dia mouth so-te fly nearly enter. Dem shock reach bone.
Di next ting be say we hear pom, pom, pom for our door. All of us come shout at di same time, “Na who be dat!!!”
(to be continued)
Make we jam again for Friday.
Tank you.
Tank you very much.
And tank you very, very much indeed.