NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.
Di US Supreme Court on Friday 27 June issue ruling wey go curb judges powers to block President Trump orders nationwide.
Di case na from President Donald Trump order to end di constitutional right of birthright citizenship for children of undocumented immigrants.
Almost evrione wey dem born for US territory dey get automatic citizenship.
Afta plenti courts suspend Trump order, im administration bin appeal to Supreme Court and argue say lower judges no get di right to block presidential actions.
E bin get one conservative majority in di Supreme Court and na Trump appoint three of di nine justices.Justices split along ideological lines
Di justices bin vote 6-3, wit di liberals dissenting. Di conservative justices bin stress say dem no dey address di merits of Trump attempt to end birthright citizenship for non-citizens and undocumented migrants.
Justice Sonia Sotomayor, di senior most liberal justice, bin deliver different opinion wit justices Elena Kagan and Ketanji Brown Jackson wey join.
Here na wetin she write: "Undeterred, di Goment now ask dis Court to grant emergency relief, insist say e go suffer irreparable harm unless e fit deprive at least some children wey dem born in di United States of citizenship... Di gamesmanship in dis request dey apparent and di goment make no attempt to hide am.
"Yet, shamefully, dis Court dey play along. One majority of dis Court decide say dis applications, of all cases, provide di appropriate occasion to resolve di question of universal injunctions and end di centuries-old practice once and for all. For im rush to do so di Court disregard basic principles of equity as well as di long history of injunctive relief grant to nonparties."Supreme Court limit lower judges ability to block presidential ordersDi Supreme court from dia rulling don limit di ability of judges for lower courts to block presidential orders nationwide.
E appear to be win for di Trump Administration, wey don appeal to di Supreme Court say lower courts no get di right to block presidential actions.
Di 119 pages long document wey di BBC bin read through show say e no go be clear upheld or rejected decision from di court.
Trump win, but e fit be double-edged sword for future RepublicansBBC chief North America correspondent, bin report from Washington DC say di ruling na ogbonge win for di Trump administration and di president.
Nationwide injunctions on Donald Trump plenti executive orders don anger am and frustrate im agenda.
And while dis injunctions no dey removed entirely, dia scope dey significantly limited. E go dey harder for individuals and groups to prevent controversial policies like di ending of birthright citizenship to dey enforced.
Importantly though, di challenges to dis policies go still proceed through di courts, potentially right up to di Supreme Court – and di merits or constitutionality of each case na separate question to wetin dem decide today.
Dis na issue wey administrations of both complexions don complain about, so expect Republicans to see dis as a double-edged sword.
Wen and if a Democrat enta di White House, dem go enjoy di same legal advantages as Donald Trump go now make di most of. Much work go also dey for lawyers – and who no dey in favour of dat!
Wetin dey di birthright citizenship case?
On im inauguration day for January, President Trump bin issue one executive order to cancel birthright citizenship for babies wey dem born to pipo in di US temporarily and undocumented migrants.
Many legal experts tok say di president no get di power to end birthright citizenship sake of say e dey guaranteed by di 14th Amendment of di US Constitution.
Di amendment tok say "all pesins wey dem born or naturalise in di United States, and subject to di jurisdiction thereof, be citizens".
Trump order argue say di phrase "jurisdiction thereof" mean say automatic citizenship no apply to di children of undocumented immigrants, or pipo wey dey di kontri temporarily.
Federal justices for Maryland, Massachusetts and Washington, however, issue nationwide - or universal - injunctions wey block di order make e no dey enforced.
Di injunctions, in turn, bin prompt di Trump administration to argue say di lower courts pass dia powers. Di administration ask di court to rule say di injunctions fit only apply to dose immigrants wey dey named in di case or to di plaintiff states – wey go allow di goment to at least partly carry out Trump order even as legal battles dey continue. (BBC)