Dem wan make me Honorable (2)

News Express |26th Nov 2021 | 1,036
Dem wan make me Honorable (2)



Oga Chairman stand up for im office for Council and shake me, den e say make I siddon for one big chair wey dey near.

As I siddon, Chair tell everybody to comot and lef only di two both of us for inside di office. I no still understand wetin dey for Chair mind.

Wen e come remain only me and Chair, e tell me say all di Chair for Lagos hold meeting with Asiwaju yesterday. Asiwaju tell dem make dem give name of di people wey dem wan make dem take over, as dia own time as Chair don dey finish.

Chair tell me say for Ikeja o, na Asiwaju gangan tell am say na one taxi driver wey be union secretary for di taxi park wey dey near Ikeja under bridge e wan make e be di next Honorable.

Asiwaju? Me? Honourable? I no come know di time wen my mouth open and begin trowey all di above question for Chair.

Chair jus tell me say, “yes, you!”

E say noting wey I go fit do to escape am.

I ask Chair why be say na me of all people Asiwaju come select. Me wey no get shi shi for pocket. Me wey no sabi write one line for paper. Me wey be say minute of our union meeting na my two woman pikin dem – Bisi and Funke – dey always helep me write wen I reach house after meeting for garage.

Chair say make all dat one no disturb me, say Asiwaju don take care of everyting. E talk say dem don even register me for di party already. Tori Olorun!

E say di ting be say, as Asiwaju wan be Presido for 2023 so, e wan make only im boys dey for position dey arrange tings underground. Na im make MC Olomo dey standby as our next Oga patapata for Lagos.

E come talk say as MC Olomo go be His Excellency, me I go dey incharge for Ikeja as di Honorable. Chair say na di message e get for me be dat, make I go, tink about it and come back next week.

I no know wen I shout, Olorun Oba o!

I jus hear person nack my back say: “Oga MAT wake up. Dis your maleria don come back. Take agbo, you no go gree.”

I open my eye, I see say na our union treasurer, Idowu dey talk to me, dey laugh. Mtcheewwww!!!

Make we jam again on Tuesday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

Comments

Post Comment

Monday, October 13, 2025 2:20 AM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025