Dem wan make me Honorable

News Express |23rd Nov 2021 | 977
Dem wan make me Honorable



As 2023 don dey near small small, everybody for Naija don dey do orisirisi plan wey go bring money.

E get some place for dis our contry wey be say na only two type of work dey - if you no dey for politrick and answer honorable, na im be say you be pastor or afah. Na di only two factory wey dey be dat.

Na so I siddon di order day dey look road ti-ti-ti-ti weda any passenger go show face for our garage wey dey near Ikeja under bridge.

I look road sote my eye begin chuk...

E no too tey, na im one bobo like dat waka straight come meet me for inside my guonguoro wey I siddon dey enjoy KWAM1 music for di new system wey I buy put for my guonguoro last week becos of odun wey dey come so.

Di bobo na my customer, e dey work with Oga Chairman for Council. Everybody for Council dey call am PA. Anytime dem wan extra motor for Council, na my guonguoro dem dey charter join. And dem dey pay me well.

Na im make my belle sweet as I jus see PA for our garage. I talk am for my mind say, patapata 10k go enter my pocket today.

PA come tell me say, Oga Chairman wan see me for Council. I say shiioorr!!! Chair wan see me? I come dey tink wetin I do wey make Chair wan see me for Council. Abi somebody don go report me or somebody don do bad ting and come mention my name? Na so my heart begin do jigi jigi like railway.

I ask PA wetin I do wey make Chair wan see me. PA swear say e no know, but dat e sure say no be bad ting. Hmmm, who go believe all dis politrikcian dem?

I tell PA say make e wait make I call my wife Bose say Chair dey wait for me for Council. And I go also tell my union member dem say PA don come carry me o.

PA come laugh. E say make afraid no catch me, say e sure say na better ting Chair wan see me for, even dough e no tell am.

Na so I open front door of my guonguoro make PA enter. We begin go Council.

As we reach Chair office, na so my heart dey pound like pounded yam mortar. Chair sef notice am and e come tell me say, “Oga MAT calm down. Nothing to fear. In fact, congratulations the honourable!”

(To be continued)

Make we jam again on Friday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

Comments

Post Comment

Monday, October 13, 2025 2:20 AM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025