Love medicine for sale (4)

News Express |19th Nov 2021 | 930
Love medicine for sale (4)



Di madam come dey show di Akoka school hostel sisi dem di market one by one and how to use di cream.

E say, “Dis one na for any Senator wey you wan catch, weda for Abuja or for Lagos.

“If you wan comot like tomorrow morning, you go first rob am for your face for night wen you wan sleep. Wen you wake up for morning, you baf, wear fine clothe, mix am with makeup and rob am again for your face. Any Senator wey see you, even if your face resemble Chimpanzee, di Senator must to call you.”

Di madam come say make dem check di label wey dey for di bottle body, say na Ghana product and e no dey fail lai lai. Di madam say if e fail, make dem collect dia money back.

Na so di madam bring out all di market one by one. E say if any sisi wan banker, e dey. Army General own dey. Oil company director o, businessman o, minister o, Alhaji o, church GO o, all dey.

Governor own sef dey, but na dat one cost pass.

One sisi ask weda any one dey for Obi Cubana. Di madam promise am say e go bring am next week.

We no even spend like 20 minute for di Akoka school hostel, di big Ghana-Must-Go bag empty patapata. And na so di madam smile till I drop am back for Ikeja bus top.

Before e come down sef, di madam pay me my money complete, e even add jara for me.

Make we jam again on Tuesday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

Comments

Post Comment

Monday, October 13, 2025 2:28 AM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025