Love medicine for sale (2)

News Express |12th Nov 2021 | 867
Love medicine for sale (2)



I come ask di madam wey come our garage with big Ghana-Must-Go bag weda e jus wan see Oga MAT face, abi e wan do business.

Di madam say e wan take Oga MAT for charter go one school wey dey for Akoka Yaba, and e ready to pay any amount becos na business e wan go do for di school.

I ask am what kind business e dey do, di madam say na market e wan go sell for di school. E say di big bag wey e carry so, na market full am.

I tell di madam make e open di bag make I see di market. Una no go blame me nau. Now na orisirisi market people dey carry. Some go carry human head for bag, dem go tell you say na market. Gbomo gbomo sef fit carry small pikin for inside bag, all na market.

Wen e open, I see say na body cream wey dem fill inside small small bottle full di bag.

I ask di madam how much e ready to pay Oga MAT for di charter go dat school for Akoka Yaba, and make e remember say dat time na babanla Go Slow time.

Di madam look im time, e talk say na im make e come early make e for begin go di school before 8 O’clock a.m in di morning nack.

Di madam ask me weda na me dey price market for Oga MAT. E tell me say if dis one no be Oga MAT garage, make I tell am quick instead make I dey ask am question upandan.

Wen I see say di madam wan begin vex, na im I tell am say na me be Oga MAT.

Chaaaiii!!! If you see as di madam troway im market and jump for my body, you go tink say e don kolo.

Di madam jus dey shout, "Is a lie! Is a lie!! Is a lie!!!

(To be continued)

Make we jam again on Tuesday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

Comments

Post Comment

Monday, October 13, 2025 2:28 AM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025