As mber month don get belle so, noting wey person no go see for im ear and hear for im two naked eye. Everybody jus dey find money kati kati to take do odun Keresimesi and New Year.
Na so I siddon yesterday for our garage wey dey near Ikeja under bridge, one madam like dat carry big Ghana-Must-Go bag, waka come meet me. E ask me weda na for dis garage Oga MAT dey.
As correct Naija man, me sef take question jam im own question. I ask am, madam I hope noting o. Di madam say noting.
E come talk say e dey always read am for newspaper say Oga MAT, di popular Lagos taxi driver garage dey near Ikeja under bridge, after second gate bus stop.
Di way di madam take talk oyibo, you go jus know say na Ghana woman. E nearly change Oga MAT to Oga MET. Lagos, e say na Leges. Even second gate come be secand git. Bus stop nko? Dat one na bas stap.
Minus how e speak oyibo sef, di madam body colour na pure Ghana. I know come know im body and charcoal who black pass.
I come talk am for my mind say, if dis kind black madam make mistake marry black man, na im be say di two both of dem go jus born night.
I ask di madam why e dey find Oga MAT. And if e see Oga MAT weda e go know am.
Di madam say e never see Oga MAT before, say e jus dey read all di sweet sweet tori wey Oga MAT dey nack for inside newspaper. E say e read one time like dat wey Oga Sanwo-Olu give Oga MAT award. E also say dat last year during Coro lockdown, na only Oga MAT be di taxi driver wey gofment gree make e put im guonguoro for road. Na im make e sabi say Oga MAT go be better taxi driver.
(To be continued)
Make we jam again on Friday.
Tank you
Tank you very much
And tank you very, very much indeed.
NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.