Ashewo don cause katakata for garage (2)

News Express |5th Nov 2021 | 856
Ashewo don cause katakata for garage (2)



And wetin di sisi dey shout as e hold Mutiu for shokoto trouser no good make anoder ear hear am.

Di sisi tell Mutiu say: “I don catch you today. Shebi you tink say I no go fit see you again. You come di hotel wey I dey do my runs for Shogunle, you f..k me di first day, you no pay. You come di second day, f..k me again, you no pay.

“Wen I ask you, you say you be my good customer and you wan use e-Naira pay me. You say e-Naira better pass dollar sef ten times. You tell me say make I wait till Oga patapata launch di e-Naira.

“Since dat day, I no see you again. Naira I no see, e-Naira I no see. And I hear say oga patapata don launch di e-Naira for Abuja since last month.

“Now I don catch you. You must to pay me my correct money for di two days wey I service you. I even dey put fisi for you. Keep your e-Naira, I no want am again. Pay me with di Naira wey everybody know.”

As di ashewo mouth dey do ta-ta-ta-ta like typewriter, nobody put mouth. Dis kind one fit break bottle scatter person head nau.

Mutiu jus bend im head down, e no fit look up. Shame finish am. Nobody know say Mutiu get ashewo customer for hotel. We tink say na only igbo and monkey tail e sabi shack.

Jimoh come ask di ashewo how much be Mutiu money. Di ashewo say e for be 6k for di two days. But as e be say Mutiu no dey use rubber, e dey like to do biebie to biebie, di money don jump to 9k. Plus 1k VAT. Tori Olorun!

My broda, na so all of us contribute 10k and give to di ogbologbo ashewo before e gree release Mutiu for shokoto trouser o.

Make we jam again on Tuesday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

Comments

Post Comment

Monday, October 13, 2025 4:47 AM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025