Madam Shine don get title for lie lie

News Express |26th Oct 2021 | 826
Madam Shine don get title for lie lie



I no dey too like to put my guonguoro for road till night on Saturday and Sunday.

Wen man don work ti-ti-ti-ti from Monday, e suppose to find time and play small with im family for weekend. After all, oyibo dey talk am say body no be wood.

But last Saturday morning, I go drop one passenger like dat for Akuwonjo. Before I come reach our garage wey dey near Ikeja under bridge, time don nack 11 o'clock am in di morning.

I jus say make I go take one bottle of My Usual for Madam Shine Buka wey dey near Airport Hotel, before I begin go relax with my family for Abule Egba.

As I enter di buka, Sikiratu and im madam surprise to see me for morning time. Dem know me say, na wen I don do wahala for Lagos road finish for day time, den for night I go come take My Usual and pepper soup, before I begin go house.

Sikiratu run come hold me, e ask me why I come by dis time. I tell am say I jus wan come see im face small before I begin go house. Sikiratu mind come sweet well well. E say no wonder, becos e know say I no dey too show face Saturday and Sunday.

I no even siddon wen Madam Shine come meet me. E begin ask me weda I sabi say e be big woman for London before e come back for Naija come open dis buka.

E say make I no look am say, becos e come dey sell beer and pepper soup, e be small woman o.

E say for London, Queen and im husband wey jus peme sabi am well well. E say na every weekend dem dey invite am for lunch for Palace.

E say na im make e use dat connection dey helep Naija people wey dey for oyibo land. E say dat’s why everybody come dey call am Big Mummy.

As Madam Shine dey nack me dis tori, na so e dey show me orisirisi photo. E show me wen e stand with Queen. E show me wen e stand with oyibo MP dem. E show me wen Naija people for London dey hail am. I say na wa o.

E come begin show me photo wey e stand with Oga Lai. E say im and Oga Lai dey talk everyday.

I see say wen Sikiratu wan serve me My Usual as Madam Shine dey show me photo, Sikiratu dey cut eye for me. But I no understand.

(To be continued)

Make we jam again on Friday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

Comments

Post Comment

Monday, October 13, 2025 4:47 AM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025