Quick, quick, I collect my torch light chinko phone for Idowu hand. Abeg, make e use im own phone call im agbo customer if e really wan talk to am.
I pick Sikiratu call. I come hail am, “Hello, my Siki Babe!”
Sikiratu say, “My darling Oga MAT. Shey you see dis rain?”
“I see di rain o, my Siki Babe. And di kind cold wey dey catch person for here na helele,” I tell Sikiratu.
Sikiratu come talk say na becos of di rain e call me as motor no dey for road make e come meet me for our garage wey dey near Ikeja under bridge.
E say e know say cold go don dey catch me. E say di kind cold wey dey hold am now for inside dia buka, no be small ting.
As we dey talk, I dey hear one kind sound for background. I ask Sikiratu who dey with am for dia. E say na only am dey for di buka. E say as e jus enter di buka dis morning na im di heavy rain start, and nobody don come since day time. E say even Madam Shine wey get di buka never come.
I tell Sikiratu say but I dey hear one kind sound for di background. E say make I forgot di yeye sound make we talk better for dis cold weather. E say e fit be network wahala.
I come stand up for wia I siddon before with our union member dem, go tanda for one corner.
Na so me and Sikiratu begin dey do lovu nwantinti for phone for dat cold weather o. Tori Olorun!
(To be continued)
Make we jam again on Friday.
Tank you
Tank you very much
And tank you very, very much indeed.
NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.