I no come know why be say na me Jumoke call. I no be im custormer. Na Mutui, Jimoh and Idowu dey always buy hot agbo for Jumoke hand.
If you hear say Jumoke buy car today, make you know say dose three our union member dem wey be im agbo customer dia money dey inside.
No day wey dem no dey drink Jumoke agbo – morning, afternoon and night. If you ask, dem go say agbo dey make dia body strong kakaraka like iron.
I pick Jumoke call, I no talk. Na im e come say, “Hello”.
Di way I reply am “Hello”, to slap am sef for better.
“Aah, Aah, Oga MAT shey we dey fight? Abeg no vex as I call you. I know say you no be my customer. You never buy my market before. I call you becos Jimoh, Idowu and Mutiu dem phone no dey go. I no know weda na network cause am. But your own line go one hand. Abeg, Idowu dem dey near you dia?”
I no make fem. I jus give di phone to Idowu wey siddon near me as we dey nack tori of passenger dem wey dey talk like parrot.
As Idowu collect di phone to receive di call, e ask me who dey for line. I tell am say na im agbo customer, Jumoke.
Idowu come shout “Jummy, Jummy! How your body? So you remember me for dis cold weather!”
As Idowu dey talk, I come hear say anoder call dey try to come in. I say make Idowu look who dey call. Idowu use hand cover di phone, and come talk small small say na Sikiratu.
(To be continued)
Make we jam again on Tuesday.
Tank you
Tank you very much
And tank you very, very much indeed.
NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.