Abi, Sikiratu dey record my voice?

News Express |28th Sep 2021 | 915
Abi, Sikiratu dey record my voice?



Noting wey person no go hear for dis Lagos. Di kind orisirisi tings wey we taxi driver dey take our mouth hear and see, our ear no fit talk am.

Di tings wey dey happen for road, na small ting sef. If you know di orisirisi tings wey we dey hear for passenger dem mouth, ehn!

Plenty passenger na parrot dem be. As dem jus enter taxi like dis, na so dia mouth go begin do like typewriter ta-ta-ta-ta-ta till dem go down.

And if you come make mistake carry two woman dem, your own don finish be dat. If your ear no begin pain you wen dem drop, na im be say Eledumare like you.

Na all dis ting me and our union member dem siddon dey talk yesterday for our garage wey dey near Ikeja under bridge.

Rain fall well well, na im make nobody gree put im taxi for road. Me sef wey be say I dey hold my guonguoro like egg, I no fit get mind to take am enter Lagos road wen heavy rain dey fall rarara. I no wan make my guonguoro begin swim for Lagoon.

Our Union treasurer, Idowu talk im own. Our chairman, Jimoh talk im own. Akpan, wey be our social organiser, talk im own. Emeka and Mutiu talk dia own. If you hear di orisirisi tings wey we dey hear for passenger dia mouth, e reach to take write book.

As we dey nack our tori dey go, na im my torch light chinko phone begin ring grin, grin, grin!

I come dey struggle to bring out di phone for inside my shokoto trouser, na so my finger cut di call by mistake. I talk am for my mind say, well, di person go call again.

I no even talk am finish, di phone begin ring again. I quick, quick bring am out and check. Na Jumoke dey call – di sisi wey dey carry hot agbo come sell for our garage.

(To be continued)

Make we jam again on Friday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

Comments

Post Comment

Monday, October 13, 2025 7:12 AM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025