After di afin and aboki ting, e come be yesterday morning again.
I dey prepare to go our garage wey dey near Ikeja under bridge. Bose and Bisi don go Monday morning prayer for dia church, e come remain me and Funke for house.
I ask Funke why e no follow im mama and im senior sister go church. E say e wan make I helep am sign one guarantor form as I be im papa.
Na so Funke show me one paper like dat. I ask am which kind paper be dat. E say e wan follow go do one programme for television wey dem go pay am N85 Million if e win.
E say e go use part of di money take build house for me and im mama, make we comot for dis yeye Baba Braimoh face-me-I-face-you house.
E say e go also use di money buy one tear rubber car for my taxi driver work, make I trowey dis my guonguoro wey I don dey drive for Lagos road since Azikiwe, Awolowo and Ahmadu Bello time.
E say e go use di remaining money take open business for imsef, im mama and im senior sister Bisi.
I come tank Funke well well. I begin pray for am say, as e dey plan better for di family, im own pikin dem go do better for am too.
But I come ask am which television programme go pay am dat kind plenty money. N85 Million! Funke smile, den come tell me say na BBNaija. Tori Olorun!
I say good. I tell am say make e wait for me for inside room, make I go parlour go bring biro and sign guarantor kia kia. Funke say, "Tank you daddy, you are di best daddy in di world!"
Wen I come back, I tanda for outside call Funke make
e bring di form make I sign guarantor.
As e give me di paper, na so I keep am for ground, pour di kerosene wey I go carry for kitchen, strike matches and burn di paper patapata.
BBNaija ko, BBCotounu ni. No be from my house my pikin go follow go dey do ashewo for television.
Make we jam again on Tuesday.
Tank you
Tank you very much
And tank you very, very much indeed.
NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.