My two woman pikin dem – Bisi and Funke – don jam JAMB since last year. But to get admission enter uniservity come be wahala.
I no know weda dis gofment wan make my pikin dem spoil finish. Olorun maje!
Na im make I no dey stop dem every time dem wan follow dia mama go dia church wey dey for Pen Cinema, even dough me I no dey go church or mosque.
Sote dem even be choir sef, and dia pastor like dem gan. I like am so becos, if I lef dem for house everyday, I no go know wetin dem dey do or wia dem dey go wen I don carry my guonguoro chuk head put for road?
But Funke surprise me yesterday gan. I don dey talk am tele tele say, if no be say I trust my wife Bose, I for don carry dat my second pikin go for hospital go do test weda true, true na me born am.
Funke too tear eye. One time like dat e say e wan marry oyibo, and e come be afin wey dey carry load for Ojota garage. Agbero! I nearly kill am dat day.
Anoder time, one morning like dat wey I forgot someting for house and I rush come back, I no see Funke for house. Im senior sister, Bisi tell me say Funke don comot. E say Funke go inside bush for di back of our street wey we dey live for Abule Egba.
As we jus dey talk, na im Funke come back. I ask am wetin e go do for inside bush. E first look ground, come take leg dey draw map. Den e come tell me say e been go inside bush go see im friend. Friend? Inside bush?
E say yes, say im friend name na Abdullahi, di aboki wey dey carry cows pass our street go inside bush everyday. E remain small make I use stone take scatter Funke head dat day.
(To be continued)
Make we jam again on Friday
Tank you
Tank you very much
And tank you very, very much indeed.
NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.