Yesterday morning, heavy rain dey fall for Lagos. Una kukuma sabi as Lagos roads dey be wen small rain jus shower small, and e come be say dat yesterday own no be shower, na better rain.
Na im make all of us siddon for our garage wey dey near Ikeja under bridge. Di only person wey no dey dia na Jimoh, our union chairman.
Di rest of our union member dem dey for garage dey wait for time wey di rain go stop make we enter road.
Di tori wey we dey yarn na as soja beat one taxi driver for Plateau Friday night sote di driver peme. Haba!
Na dat one we still dey talk wen my torch light chinko phone begin ring. I look, I no see any name, na im I no gree pick di call. I no know weda na all dis Yahoo Yahoo wey dey always disturb person for phone.
We still dey nack dat Plateau soja and taxi driver tori wen Idowu, our union treasurer, phone ring. Idowu sef no know who dey call am as name no show.
Wen I look Idowu phone, I see say na dat same number wey call me na im call Idowu. Na im I come call di number back.
Na so one bobo talk say na im dey call us since but we no gree pick. Di bobo say e see our number for one taxi driver phone wey dem trowey inside gutter.
Di person say di name wey dem see for di taxi driver ID card na Jimoh Azeez, Chairman, Taxi Drivers Association, Ikeja.
E say na soja beat Jimoh, take gun break im head and trowey am inside gutter for Ojuelegba. Tori Olorun!
(To be continued)
Make we jam again on Friday.
Tank you
Tank you very much
And tank you very, very much indeed.
NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.